Mark 10
10
Divorce
1Jesus komot for dat place go Judea and Jordan River aria. Plenty pipol still gada kom meet am. E kon bigin tish dem as e dey do evritime.
2Den, some Farisee pipol wey won test am kon ask am, “E bad make man drive en wife at-all?”
3Jesus ask dem, “Wetin Moses kommand una?”
4Dem ansa, “Moses sey make man rite leta to divorce en wife.”
5But Jesus tell dem, “E tell una to do so, bikos una heart strong well-well. 6But from di time God kreate di world, na man and woman naim E make. 7Na dis make man dey leave en papa and mama go join en wife 8and di two of dem go bi one. So dem nor go bi two again, but dem go bi one body. 9So, wetin God don join togeda, make nobody separate am.”
10Wen dem enter di house again, en disciples kon ask am about di matter. 11Jesus ansa dem, “Anybody wey drive en wife, den e go marry anoda woman, don kommit adultery. 12And any woman wey leave en husband, den e go marry anoda man, don kommit adultery too.”
Jesus And Small-small Shidren
13Pipol kon dey bring shidren kom meet Jesus make e tosh dem, but en disciples dey shaut for di pipol wey bring dem kom. 14But wen Jesus si wetin dey happen, e vex kon tell en disciples, “Make una allow small-small shidren kom meet mi, nor stop dem, bikos na pipol like dem, go enter God Kingdom. 15I tell una true word, anybody wey nor receive God Kingdom like small shidren, nor go ever enter inside.” 16Afta, Jesus draw di shidren near body kon bless dem.
Di Rish Man
17As Jesus dey waka for road, one man run kom meet am sey, “Good Tisha, wetin I go do make I for get life wey nor dey end?”
18Jesus ansa am, “Why yu dey koll mi good? Nobody good espect God. 19Yu know di kommandment; nor kill pesin, nor sleep with pesin wey yu nor marry, nor tif, nor lie for pesin head, nor shit pesin, respet yor papa and mama.”
20Di man kon tell Jesus, “Tisha, I dey obey all dis law with all my heart since I bi small pikin.”
21As Jesus look am, e kon feel for am, den e tell am, “E get one tin wey yu neva do. Go sell all wetin yu get, give poor pipol di money and yu go get plenty propaty for heaven. Den make yu kom follow mi.”
22Wen di man hear dis word, e vex komot der, bikos e get plenty money.
23Den Jesus look round kon tell en disciples, “E go hard well-well for pipol wey get money well-well to enter God Kingdom!”
24Di disciple sopraiz for wetin Jesus tok. But Jesus tell dem again, “My shidren, e go hard well-well to enter God Kingdom o-o! 25E go dey eazy for kamel to pass nidol whole, dan for pipol wey get money well-well to enter God Kingdom.”
26Dem sopraiz more-more kon dey ask each oda, “Den, who God go save?”
27Jesus look dem kon ansa, “Dis tins hard well-well for human being, but nor bi for God, bikos evritin dey possibol for God.”
28Pita kon tell am, “Si! Wot of wi wey don leave evritin wey wi get kon follow yu?”
29Jesus ansa, “I tell una true word, e nor get anybody wey leave en house, brodas, sistas, papa, mama, shidren or land bikos of di gospel, 30wey nor go receive hundred times more dan di house, brodas, sistas, papa, mama, shidren and land wey e leave for dis world. Aldo e nor go eazy for dem, but di life wey nor go end for di world wey dey kom, go bi dia own. 31But many pipol wey bi first naw, go bi last and pipol wey bi last naw, go bi first.”
Jesus Tok About En Deat And Resureshon Again
32Jesus and en disciples kon dey go Jerusalem. As Jesus dey waka for dia front, di disciples konfuse and doz wey dey follow dem kon dey fear, bikos dem nor know wetin go happen for der. Jesus koll en twelf disciples go korna again kon bigin tell dem wetin go happen to am. 33“Si, wi dey go Jerusalem and dem go sell Man Pikin give di priest oga dem and di law tishas. Dem go kondemn am and dem go gi-am to di Gentile pipol. 34Dem go laf am, spit for en body, flog am well-well kon kill-am, but afta three days, e go wake-up.”
James and John Beg Jesus
35Zebedee shidren, James and John, kom meet Jesus sey, “Tisha, wi wont make yu do wetin wi won beg yu.”
36Jesus kon ask dem, “Wetin una wont make I do for una?”
37Dem ansa, “Make yu allow us sidan with yu for yor kingdom, one for yor rite and di oda for yor left hand.”
38Jesus ask dem, “Una know wetin una dey ask for so? Una go fit drink from di cup wey I go drink from? Abi una go fit bear di baptizim wey dem go baptize mi?”
39Dem ansa, “Wi go fit.” Den Jesus tell dem, “Una go really drink from di cup wey I go drink from and una go fit bear di baptizim wey dem go baptize mi, 40but nor bi mi go tok who go sidan for my left or rite side, bikos e get di pipol wey God prepare am for.”
41Wen di oda ten disciples hear wetin Zebedee shidren tell Jesus, dem kon dey vex for dem. 42Jesus koll and tell dem, “Una know sey pipol wey dey rule di Gentile pipol dey do oga for dem and pipol wey dey high place dey use dia pozishon dey opress pipol. 43But nor bi so e suppose bi among una. Anybody wey won bi oga among una, must bi una savant 44and anybody wey won bi first among una, must bi evribody savant. 45Bikos even Man Pikin nor kom make dem serve am, but e kom to serve pipol and to give en life make many pipol for dey save.”
Jesus Heal Bartimaeus Wey Blind
46Dem kon go Jeriko. As Jesus and en disciples with plenty pipol dey komot for der, Bartimaeus wey bi Timaeus pikin, one beggar wey blind, sidan for road dey beg. 47Wen e hear sey na Jesus wey kom from Nazaret dey pass, e kon bigin shaut, “Jesus Christ, David pikin, make yu sorry for mi o-o!”
48Many pipol kon dey shaut for am make e kwayet, but e kon dey shaut more-more sey, “David pikin, sorry for mi o-o!”
49Jesus stop kon sey, “Make una koll am kom.” So, dem tell di blind man, “Make yu happy! Get up bikos Jesus dey koll yu.” 50Bartimaeus trowey di klot wey e take kover body kon jump up go meet Jesus.
51Den Jesus ask am, “Wetin yu wont make I do for yu?”
Di blind man ansa, “Tisha, make my eye open, make I for fit si again.”
52So, Jesus tell am, “Go, yor faith don heal yu.” At wons, di man kon dey si and e kon follow Jesus.
Currently Selected:
Mark 10: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: