Levitikus 26
26
To Obey God
1God tell dem, “Make una nor make juju for unasef or make image, pila, stone kon dey woship am. Na mi bi di Oga una God. 2Una must keep di Sabat Day and honor di place where dem for dey woship mi. Na mi bi Oga God.
To Obey Dey Good
3“If una keep my law and obey my kommand, 4I go send una rain for di korrect time, so dat una land go produce food and una trees go bear fruits. 5Una harvest go plenty well-well, sotey una go still dey harvest korn until di time to pick grape and una go still dey pick grape for di time to plant korn. Una go get all wetin una won chop and una nor go fear for di land wey una dey stay. 6I go give una peace for una land and fear nor go katch una wen una dey sleep. I go kill all di wild animals for di land and war nor go dey der. 7Una go ovakom una enemies. 8Five of una go fit win hundred pipol and hundred of una go win 10,000 pipol. 9I go bless and give una many shidren; I go keep my own part for di kovenant wey I make with una. 10Una harvest go remain enter anoda year and una go even trowey wetin remain for di old harvest, so dat una go get space to put di new ones. 11I go stay with una for inside my holy tent and I nor go ever komot for where una dey. 12I go dey with una; I go bi una God and una go bi my pipol. 13Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt, so dat una nor go bi slave again. I skata di pawa wey hold una for groun and I make una waka with pride.”
To Disobey God
14God kon tell dem, “If una nor obey my kommand, I go ponish una. 15If una nor gri obey my law, kommand or keep di kovenant wey I make with una, 16I go ponish una. I go bring distroshon to una; diziz wey dem nor go fit cure and fever wey go make una blind, naim I go take waste una life. Una go plant una seed, but e nor go produce good food for una, bikos una enemies go win una kon chop wetin una plant. 17I go turn against una kon make una enemies win and di pipol wey hate una, go rule una. Fear go katch una sotey una go dey run wen nobody dey porshu una.
18“If afta all dis tins happen and una nor still obey mi, I go inkrease una ponishment seven times. 19I go break una strong pride; una nor go get rain; una land go dry kon strong like iron. 20All una hard work nor go do una good, bikos una land nor go produce food and di trees nor go bear fruit.
21“If una kontinue to rijet mi and una nor gri obey mi, I go inkrease una ponishment seven times again. 22I go send wild animals among una and dem go kill una shidren; distroy una animal kon kill una pipol and di road go dey dry.
23“If afta all dis ponishment una still nor listin to mi, but kontinue to rijet mi, 24I go turn kon ponish una seven times and e go worse pass di ones wey I ponish una before. 25I go ponish una with war, bikos una nor keep di kovenant wey I make with una and if una gada for una towns make una for dey save, I go send diziz wey dem nor dey fit cure among una and una enemies go win una. 26Una nor go get food to chop and ten wimen go dey bake all dia bread wey dem get for only one oven. Dem go share am and afta una don chop finish, una go still dey hongry.
27“If afta all dis tins happen, una still dey rijet or disobey mi, 28I go turn against una. Bikos I dey vex, di ponishment wey I go give una go bad seven times pass di ones wey I give una before. 29Una go dey hongry sotey una go dey chop una own shidren. 30I go distroy di place where una for dey woship on-top di hills kon skata una incense altars, den kill and trowey una dead body near una juju wey don fall. I go rijet una finish. 31I go distroy una towns kon skata di place where una for dey woship and I nor go asept una sakrifice. 32I go distroy una land finish and una enemies wey dey stay der before, go shok for di kind distroshon. 33I go make war happen to una and I go skata una go strenj land. Nobody go dey di land and I go distroy una towns. 34Den di years for komplete rest wey una nor gri give di land, go kon happen; 35nobody go dey der and e go kon get en rest wen una enemies don karry una go dia land.
36“I go make some among una wey una enemies karry go dia land dey fear well-well, sotey if una hear leaf sound wey breeze blow, una go dey run. Una go run like sey dem dey porshu una for war and una go fall wen no enemy dey near una. 37Una go dey shake as if pesin dey porshu una and una nor go fit fight with una enemies. 38Una go die for una enemies land and di land go swallow una.
Konfess And Ripent
39“Doz of una wey nor go die for una enemy land go waste trowey, bikos of una and una grand-grand papa sin. 40Una shidren-shidren go konfess both dia sin and dia grand-grand papa own, wey rijet and dey sturbon to mi, 41kon make mi turn against and give dem as slave to dia enemies. But wen una shidren-shidren honbol demsef and dem pay for dia sins and sturbones, 42I go remember di kovenant wey I make with Abraham, Isaak and Jakob kon fulfil my promise, den give my pipol di land. 43All di pipol wey dey di land must komot first, make e for get komplete rest and dem must pay di prize, bikos dem rijet my law and kommand.
44“But even wen dem still dey dia enemy land, I nor go leave and distroy dem finish. Bikos dat one go make my kovenant with dem end, na mi bi di Oga dia God. 45I go renew di kovenant wey I make with dia papa wen I show all di kountries my pawa wey I take karry dem komot from Egypt, so dat mi wey bi di Oga God, go bi dia God.”
Konklusion
46All dis na di law and kommand wey God give Moses for Mount Sinai about Israel pipol.
Currently Selected:
Levitikus 26: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee