Levitikus 25
25
Di Sevent Year
1God tell Moses for Mount Sinai: 2“Make yu go tell Israel pipol sey, ‘Wen una enter di land wey I dey give una, una must nor work for di sevent year, just as God kommand. 3For six years, una go plant for una farm kon kut una gardin and gada wetin una harvest, 4but for di sevent year, una must let di land rest kon dedikate dat year to God. Una must nor plant or harvest. 5Make una nor even harvest any korn wey grow on dia own wey nobody plant and make una nor gada di grape from di gardin wey una nor kut; bikos na di year wey di land dey rest. 6Even doh una nor plant for una land dat year, di land go produce food for una, una slave, di men wey una hire to work for una, di strenjas wey dey stay for una land, 7una animals; di big animal wey dey una farm and all di tins wey di land produce, go bi food for una to chop.
Year To Free Pipol
8“ ‘Make una kount seven times seven years and e go bi forty-nine years. 9Den for di tent day for di sevent mont, di day to forgive sins, yu go send somebody go blow di trumpet for di whole land for Israel. 10Na like dis una go take make di nomba fifty year dey holy and una go free evribody wey dey stay for di land. For dis year, all di propaty wey dem don sell before, dem go gi-am back to di owner or en relashon. And anybody wey dem sell as slave, go-go back to en family. 11Una nor go plant for una farm or harvest di korn wey dey grow by ensef or gada di grape wey dey di land wey una nor kut. 12Di whole year go dey holy to una; una go chop only di food wey di land produce by ensef.
Land Propaty
13“ ‘For dis year, all di land wey dem don sell, dem go gi-am back to dia owner. 14Wen una sell land to una fellow Israel pipol or buy from dem, make una nor do wayo. 15Una go fix di prize akordin to di nomba for di year wey di land go produce food, before di year wey una go riton am. 16If di years many well-well, di prize go inkrease, but if di years small, di prize go low, bikos dem dey sell di food wey di land produce. 17Make una nor play una fellow Israel pesin wayo, but make una obey di Oga una God.
Wahala For Di Sevent Year
18“ ‘Una must obey my law and my kommandment, so dat una nor go fear for di land. 19Di land go produce food and una go chop until una beleful and una nor go fear for di land. 20If una sey, “Wetin wi go chop for di sevent year if wi nor plant or gada awa harvest?” 21I go kommand my blessing for una for di sixt year, so dat di land go produce food wey una go chop for three years. 22Even wen una plant for una farm for di eight year, una go still dey chop wetin una harvest for di sixt year and una go get plenty food to chop. Even wen una harvest for di ninet year, di ones wey una harvest for di sixt year, go still remain.
Propaty Law
23“ ‘Una nor go sell una land forever, bikos di land na God own and una bi strenja wey God allow to use di land. 24Wen dem sell di land, una go sell back to di owner wen e won buy am back. 25If any Israel pesin dey poor and una kon force am sell en land, e relashon wey dey klose to am go must buy am back. 26If pesin nor get money to buy di land back den, but leta e kon get, 27e go pay di man wey buy di land di money wey go rish to kover di remainin years, before di year wey dem go riton di land. 28But if di pesin nor get plenty money to buy di land back, di land go dey with di man wey buy am till di year wey dem go riton di land. For dat year, e go riton di land give di owner.
House Propaty
29“ ‘If anybody sell house for town wey get wall, e get di rite to buy am back for di first year wey e sell am. 30But if e nor buy am back for dat year, e nor go fit buy am back again and di house go bi di pesin and en sons own; dem nor go riton am for di year wey dem dey riton propaty. 31But house wey dey for di village wey nor get wall, dem go trit dem like field; di first owner for di house get di rite to buy di house back and dem go riton am for di year wey dem dey riton propaty. 32Levi pipol get di rite to buy dia propaty back anytime for di town wey dem share give dem. 33If Levi pesin sell one among di house for di town and dem nor buy am back, dem must riton am for di year wey dem dey riton propaty, bikos di house wey Levi pipol get for dia town, na dia permanent propaty among Israel pipol. 34But di land wey dia animal dey stay, dem nor go sell am at-all; bikos na dia propaty e bi forever.
Credit And Slave Law
35“ ‘If una fellow Israel pesin dey poor and e nor fit support ensef, una must gi-am evritin as una dey give di pipol wey una hire, so dat dem go kontinue to stay with una. 36Make una nor add intrest join, but make una obey God, so dat una fellow Israel pipol go fit stay near una. 37Make una nor add intrest for di money wey una borrow dem or gain for di food wey una sell give dem. 38Na mi bi di Oga una God wey karry una komot from Egypt kon give una Kanaan land. Na mi bi una God.
39“ ‘If una fellow Israel pipol wey dey stay near una dey poor kon sell ensef for una to bi slave, una nor go make am do di work wey oda slaves dey do. 40E go stay with una as slave wey una hire and e go serve una until di year wey dem dey riton propaty. 41For dat time, en and en sons go leave una kon go back to dia family and to dia propaty wey dia grand-grand papa get. 42Israel pipol na God savants and E karry dem komot from Egypt; so una must nor sell dem as slave. 43Make una nor trit dem anyhow, but make una obey di Oga wey bi una God. 44But for una own slaves, una fit buy dem from di kountry wey dey near una. 45Una fit still buy from di pikin wey di strenjas among una born. Doz pikin wey dem born for una land go fit bi una propaty. 46Una fit give dem to una sons and dem go serve una shidren-shidren forever. But make una nor trit any Israel pesin anyhow.
47“ ‘If di strenja wey dey stay with una kon get money and en fellow Israel pesin dey poor and e sell ensef give dat strenja to bi slave or anybody from en family, 48afta dem don sell am, e still get di rite to buy ensef back. One pesin among en brodas fit buy am back, 49or en uncle, kousin or family memba; or if en ensef get plenty money, e fit buy ensef back. 50E go meet di pesin wey buy am and dem go kount di year wey e take sell ensef until di year wey dem dey riton propaty, den dem must tok di prize for am to dey free. Dis prize na as dem take dey pay di savant wey dem hire to work. 51If many years still remain wey e go stay with dem, e go riton part of di money wey dem take buy am, so dat e go dey free. 52But if di year wey remain dey small before di year wey dem go riton propaty, e go kakulate di money wey remain and e go pay am, so dat e go dey free. 53If dem hire am for evry year, en oga nor go trit am anyhow. 54If dem nor let am go like dat, en and en sons go dey free for di year wey dem dey riton propaty, 55bikos Israel pesin nor fit bi slave forever, bikos dem bi my savant wey I karry komot from Egypt; Na mi bi di Oga wey bi dia God.’ ”
Currently Selected:
Levitikus 25: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee