YouVersion Logo
Search Icon

Joshua 16

16
Josef Tribe
1Di land wey Joshua give Josef shidren na from Jordan River side go rish di wotaside for Jeriko east; den to di desert and from Jeriko go di kountry for di hill wey bi Bethel. 2Di borda for sout wey from Bethel go Luz kon cross go Arkite aria for Atarot. 3E from der go di west side for Jafletite aria and di low arias for Bet-Horon and Geza kon end for di sea.
4Dem give Josef shidren, Manasseh and Efraim dia own part for di land.
5Di aria wey dem give Efraim and en family na:
di east for Atarot-Addar go rish top of Bet-Horon. 6E from der go di sea and Mikmetat for di nort. E still from der go di east side for Taanat-Shiloh kon cross go Janoah east. 7E from Janoah go Atarot and Naarah kon tosh Jeriko till e rish Jordan River. 8From Tappuah, e go di west side for Kanah Valley den e end for di sea. Dis na di land wey Joshua give Efraim tribe akordin to en family. 9Di big and small towns wey dem keep for Efraim family inside Manasseh aria dey join.
10Efraim pipol nor fit win all Kanaan pipol wey dey stay Geza. So Kanaan pipol still dey stay with Efraim pipol till today and dem bi Efraim pipol savant.

Currently Selected:

Joshua 16: pcm

Highlight

Copy

Compare

Share

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in