Joshua 15
15
1Di land wey dem give Judah tribe akordin to dia family, long from Edom borda go rish Zin Wildaness for Negev wey dey sout.
2Dia borda for sout start from di sout-side for di Salt Sea 3go rish Akrabbim Ascent sout kon cross go Zin, till e rish Kadesh Barnea sout kon cross from der go Hezron on-top Addar and e kom down for Karka. 4Di land cross go Azmon, till e rish Egypt wotaside kon end for di sea. Na dis bi di borda for sout.
5Di borda for east na from di Salt Sea go rish Jordan River. Di borda for nort start from di Salt Sea from Jordan River mout 6go rish Bet-Hoglah, den cross di nort for Bet-Arabah go di Stone wey bi Reuben pikin, Bohan own. 7E kom from der go Debir from Akor Valley den turn face nort go rish Gilgal (wey dey opposite Adummim Pass for di sout-side for di valley) kon cross En-Shemesh wota go rish En-Rogel. 8E from der go Ben-Hinnom Valley go rish di lowland for Jebus for sout (wey bi Jerusalem) and from der, e go on-top di hill opposite Ben-Hinnom Valley for west wey dey di end for Refah Valley for nort. 9E from der go on-top di hill go rish di spring wota for Neftoah, plus di whole town for Mount Efron, den from Mount Efron to Baalah (wey bi Kiriat-Jearim). 10E turn from Baalah face west for Mount Seir kon cross di lowland for Mount Jearim go nort (wey bi Kesalon), den land for Bet-Shemesh kon cross go Timnah. 11E still from der go Ekron lowland for nort till e rish Shikkeron, den cross go Mount Baalah, till e rish Jabneel kon end for di sea.
12Na Mediterranean Sea bi di borda for west.
And na dis bi di borda for Judah tribe and family.
13Kaleb wey bi Jefunneh son from Judah tribe, dem gi-am Kiriat-Arba (wey bi Hebron), just as God tell Joshua. (Na Arba bi Anak papa.) 14From der, Kaleb porshu Sheshai, Ahiman and Talmai wey bi Anak shidren 15kon attack Debir pipol. (Before-before, dem dey koll Debir pipol Kiriat-Sefer.) 16Kaleb kon sey, “Di pesin wey go win Kiriat-Sefer, I go gi-am my dota Aksah, as en wife.” 17Wen Otniel, Kenaz pikin wey bi Kaleb broda win am, Kaleb kon give en dota, Aksah to am as wife.
18One day Otniel kom meet and beg Aksah make e ask en papa for some land. Wen e kom down from en donkey, Kaleb kon ask am, “Na wetin yu wont.”
19E ansa, “Abeg, make yu give mi one special gift. Since yu don give mi land for Negev aria, make yu give mi spring wota.” So en papa kon gi-am both di spring for up and di one for bottom.
20Dis na di land wey dem give Judah tribe and dia family:
21Dis towns dey Judah land end for sout near Edom borda and dem bi:
Kabzeel, Eda, Jagur, 22Kinah, Dimonah, Adadah, 23Kedesh, Hazor, Itnan, 24Zif, Telem, Bealot, 25Hazor-Hadattah, Keriot Hezron (wey bi Hazor), 26Amam, Shema, Moladah, 27Hazar-Gaddah, Heshbon, Bet-Pelet, 28Hazar-Shual, Beersheba, Biziotaya, 29Baalah Lim, Ezem, 30Eltolad, Kesil, Hormah, 31Ziklag, Madmanna, Sansannah, 32Lebaot, Shilhim, Ain, Rimmon and dem bi twenty-nine big and small towns.
33Dis na di towns wey dey di lowland:
Eshtaol, Zorah, Ashnah, 34Zanoah, En-Gannim, Tappuah, Enam, 35Jarmut, Adullam, Soko, Azeka, 36Shaaraim, Aditaim and Gederah (or Gederotaim) and dem bi fourteen big and small towns. 37Zenan, Hadashah, Migdal-Gad, 38Dilean, Mizpa, Jokteel, 39Lakish, Bozgat, Eglon, 40Kabbon, Lahmas, Kitlish 41Gederot, Bet-Dagon, Naamah and Makkedah and dem bi sixteen big and small towns.
42Libnah, Eta, Ashan, 43Jeftah, Ashnah, Nezib, 44Keilah Akzib and Maresha and dem bi nine big and small towns.
45Ekron and all di towns wey dey near am; 46from Ekron west, evribody for Ashdod aria and dia towns; 47Ashdod and doz wey dey near am, plus Gaza with doz wey dey near am, go rish Egypt Stream and di borda for Mediterranean Sea.
48Dis na di towns for di kountries for hill:
Shamir, Jattir, Sokoh, 49Dannah, Kiriat-Sannah (wey bi Debir), 50Anab, Eshtemoh, Anim, 51Goshen, Holon and Gilo and dem bi eleven big and small towns.
52Arab, Dumah, Eshan, 53Janim, Bet-Tappuah, Afeka, 54Humtah, Kiriat-Arba (wey bi Hebron) and Zior and dem bi nine big and small towns.
55Maon, Karmel, Zif, Juttah, 56Jezrel, Jokdeam, Zanoah, 57Kain, Gibeah and Timnah and dem bi ten big and small towns.
58Halhul, Bet-Zur, Gedor, 59Maarat, Bet-Anot and Eltekon and dem bi six big and small towns.
60Kiriat-Baal (wey bi Kiriat-Jearim) and Rabbah and dem bi two towns.
61Dis na di towns for desert:
Bet-Arabah, Middin, Sekakah, 62Nibshan, di Salt towns and En-Gedi and dem bi six towns.
63Judah men nor fit win all Jebus pipol wey dey stay Jerusalem, so Jebus pipol still dey stay with Judah pipol till today.
Currently Selected:
Joshua 15: pcm
Highlight
Copy
Compare
Share
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee