Joshua 11
11
Israel Win Anoda War
1Wen King Jabin for Hazor hear di news, e send message go meet King Jobab for Madon; Shimron king, Akshaf king 2and all di kings for nort wey dey rule di kountries for hill, di Arabah for di sout for Kinneret, di ones for di lowland and doz ones for Dor wey dey di west, 3Kanaan pipol from di east and west; Amor, Hit, Periz and Jebus pipol from di kountry for hill and Hiv pipol from under Hermon for di aria wey dey Mizpa. 4All dis kings kom out with dia sojas and nobody fit kount dem, bikos dem many like san-san for wotaside and dia shariot many well-well too. 5All dis kings gada for Merom River side, bikos dem won fight Israel pipol.
6God tell Joshua, “Make yu nor fear dem, bikos by dis time tumoro, I go distroy dem for Israel pipol front. Yu must cripple all dia horse kon burn dia shariot.”
7So Joshua and all en sojas attack dem for Merom River side wen dem nor know sey dem dey kom. 8God give dem to Israel and en pipol kill and porshu dem go rish Greata Sidon, Misrefot-Maim and Mizpa Valley for di east. Dem kill all of dem finish. 9Joshua do dem, just as God kommand; e cripple dia horse leg kon burn dia shariot.
10For dat time, Joshua attack Hazor town kon kill en king, bikos na Hazor town dey lead all di kingdoms. 11Dem kill evribody wey dey stay der kon burn di town.
12Joshua enter all di royal towns kon kill dia kings, just as God savant, Moses kommand dem. 13But Israel pipol nor burn any town wey dey di hill, escept Hazor wey Joshua burn. 14Israel pipol karry evritin wey dey dis towns, plus dia animals, but dem kill all dia pipol finish. 15God savant, Moses, tell Joshua evritin wey God kommand and Joshua do as Moses tell am. E nor go against any of di kommand wey God tell Moses.
Israel Viktory
16Joshua win di whole land plus di kountries for hill; di Negev; all di land for Goshen; di lowlands; di Arabah; di hill kountries for Israel and en lowlands, 17from Mount Halak to Seir go rish Baal-Gad for Lebanon Valley under Mount Hermon. Joshua katch all dia kings kon kill dem. 18Joshua fight against dis kings for sometaim. 19No town make peace with Israel pipol (escept Hiv pipol wey dey stay for Gibeon.) Israel pipol win all di remainin towns, 20bikos God make di towns sturbon, so dat dem go attack Israel. God wont make Israel pipol kill dem anyhow, just as E don kommand Moses.
21For dat time, Joshua attack and kill Anak pipol for di hill kountry, Hebron, Debir and Anab from all di hill kountry for Judah and Israel. 22No Anak pesin remain among Israel pipol, but some dey for Gaza, Gat and Ashdod. 23Joshua win di whole land, just as God promise Moses. Den Joshua give di difren tribe for Israel di land, as dia own.
Den di land kon get peace and di war kon stop.
Currently Selected:
Joshua 11: pcm
Highlight
Copy
Compare
Share
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee