YouVersion Logo
Search Icon

John 1

1
How God Word Kom Meet Us
1Since wen di time start naim di Word dey and di Word dey with God and na God ensef bi di Word. 2Di Word dey with God from wen time bigin.
3Na God make evritin and if to sey E nor make dem, dem nor for dey dis world at-all. 4Na inside am life dey and na dat life bi di lite wey pipol get. 5Di lite dey shine inside darkness, but darkness nor gri with am.
6E get one man wey en name bi John, wey God send kom dis world. 7E kom bear witness for di lite, make evribody for fit get di shance to bilive wetin God tok thru en word. 8Nor bi John ensef bi di lite, but e kom tell pipol about Jesus wey bi di lite. 9Na Jesus bi di true lite wey go shine for evribody for dis world.
10E kom inside di world wey e make my ensef, but di pipol nor know am. 11E kom meet en own pipol, but dem nor wont am. 12But evribody wey receive and bilive en name, e go give dem di rite to bi God pikin. 13Dem go bi God shidren, nor bi as dia papa and mama take born dem from belle, or bikos somebody make dem so, but bikos God ensef make dem en own shidren.
14Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.
15John kon bigin shaut sey, “Dis na di pesin wey I tell una about sey, ‘Di pesin wey go kom afta mi, big pass mi, bikos e dey before mi.’ ” 16Evribody for dis world don receive plenty good tins from am. 17Na thru Moses God give us di law, but God give us favor and trut, thru Jesus Christ. 18Nobody don fit si God face before. But Jesus, wey bi God ensef, wey en and en Papa bi tait friend, na-im kom show us how God bi.
John Di Baptist Tok About Jesus
19Di Jew oga dem send priests and Levi pipol make dem go ask John sey, “Who yu bi sef?” 20E ansa dem, “I nor dey lie, bikos nor bi mi bi di Christ.”
21Den dem ask am, “So, na who yu bi? Abi yu bi Elijah?”
E kon sey, “No, I nor bi Elijah.”
Dem ask am again, “Yu bi di profet?”
E ansa, “No o-o!”
22Again, dem ask am, “Who yu bi sef? Make yu tell us, so dat wi go know wetin to tell di pipol wey send us. Who yu sey yu bi?”
23John kon sey, “Na mi bi dat vois wey dey shaut inside wildaness sey, ‘Make una make di road wey pipol go pass go meet God strait well-well’, as Profet Isaya tok before.”
24(Na di Farisee pipol send dis pipol go meet John). 25Dem kon ask John sey, “Why yu dey baptize pipol, if yu nor bi di Christ or Elijah or di Profet?”
26John ansa dem, “I dey baptize pipol with wota, but among una, one pesin dey wey una nor know. 27E go kom afta mi. I nor rish to luz di rope wey dey en shoe.”
28All dis tins happen for Betany where pipol dey cross Jordan River kom meet John, make e baptize dem.
29Wen day break, John si Jesus dey waka kom meet am, den John sey, “Make una look! Dis na di Sheep wey God send kom die, so dat God go forgive us awa sins.” 30Na dis pesin I tell una sey, “Afta mi, one man wey big pass mi go kom, bikos e dey before mi. 31Misef nor know am before, but I dey baptize pipol with wota, so dat God go show Israel pipol who Jesus bi.”
32Den John bear witness sey, “I si God Spirit wey kom down like dove from heaven kon stay for Jesus head. 33I nor know am before, but di pesin wey send mi kom baptize with wota tell mi sey, ‘Di pesin wey yu go si God Spirit kom stay on-top en head, na-im go baptize pipol with Holy Spirit.’ 34I don si am and I bear witness sey, ‘Dis man na di pesin wey God choose.’ ”
35Wen day break, John with en two disciple stand for outside. 36Dem kon dey look Jesus wen e dey waka pass, den John kon sey, “Make una look! Na dat pesin bi God Sheep.”
37Wen John two disciples hear wetin e tok, dem kon follow Jesus. 38Jesus look back kon si di disciples dey follow am. Den e ask dem, “Wetin una wont?”
Dem ansa am, “Oga God, (wey mean Tisha) where yu dey stay?”
39Jesus ansa dem, “Make una kom si am.”
So dem go si di place wey e dey stay kon stay with am dat day. Dat time na about for oklok for aftanoon.
Wetin Andru Tok About Jesus
40Andru, Simon Pita broda, na one for di disciples wey hear wetin John tok kon follow Jesus. 41E first go find en broda Simon kon tell am, “Wi don si di Mezaya”, (wey mean Christ). 42Andru kon bring Simon kom meet Jesus.
Wen Jesus si am, e tell am, “Yu bi Simon, John pikin, na Cefas (wey mean Pita) pipol go dey koll yu from today go.”
Jesus Koll More Disciples
43Wen day break, Jesus kon plan to go Galilee. Wen e si Filip, e tell am, “Make yu follow mi.”
44Filip na from Betsaida, wey bi Andru and Pita home-town. 45Wen Filip si Netanel, e tell am, “Wi don si di pesin wey Moses and di profets rite about for dia book sey, ‘En name na Jesus, wey en home-town bi Nazaret and na Josef pikin e bi.’ ”
46Netanel kon sey, “Betta tin go fit kom out from Nazaret?”
Filip ansa am, “Make yu kom si.”
47Wen Jesus si Netanel dey waka kom meet am, e kon sey, “Make una look! Dis na betta pesin wey kom from Israel, wayo nor dey en belle.”
48Netanel ask am, “How yu take know mi.”
Jesus ansa, “Before Filip koll yu wen yu dey under di tree, I don si yu.”
49Netanel sey, “Tisha, true-true, yu bi God Pikin and na yu bi Israel king.”
50Jesus tell am, “Bikos I tell yu sey I si yu under di fig tree, yu bilive wetin I tok? Bikos yu bilive, yu go si wetin big pass dis one.” 51Den e kon sey, “Wetin I dey tell una na true word, una go si heaven open and God angels go dey waka up-and-down on-top God Pikin.”

Currently Selected:

John 1: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

YouVersion uses cookies to personalize your experience. By using our website, you accept our use of cookies as described in our Privacy Policy