YouVersion Logo
Search Icon

John 2

2
Jesus Turn Wota To Wine
1Wen three days don pass, Mary, wey bi Jesus mama, go one marriage for Kana, wey dey for Galilee. 2Dem invite Jesus and en disciple for di marriage too. 3Wen wine finish, Jesus mama kon tell am, “Dia wine don finish.”
4Jesus ansa am, “Mama, why yu dey tell mi? My time neva rish.”
5So en mama kon tell di savants sey, “Anytin wey e tell una, make una do am.”
6For dat place, six big wota pot dey and only one fit kontain about twenty to thirty gallon for wota, wey di Jew pipol dey use wosh leg as dia tradishon tok.
7Jesus tell di savants, “Make una full di pots with wota.” So dem kon full all di pot with wota.
8Jesus tell dem, “Make una take some wota from di pot go give di chairman for di party.”
So, dem do as e tok. 9Wen di chairman taste di wota wey don turn to wine, bikos e nor know how e happen (but di savants wey draw di wota know), e koll di man wey dey marry kon tell am sey, 10“Wen pesin dey do party, na betta wine e dey first serve pipol, den wen di pipol don drink taya, naim e dey serve cheap wine. But yu kon keep di good wine until di party don one finish.”
11Dis na di first mirakle wey Jesus do and e happen for Kana wey dey Galilee. Dis na how e show en honor, so en disciples kon bilive am.
Jesus Klear Di Temple
12Den Jesus with en mama, brodas and en disciples kon go Kapanaum. Dem kon stay der for some days.
13By dis time, di Jew Passova Feast don near well-well, so Jesus kon go Jerusalem. 14E si di pipol dey sell melu, sheep and dove inside di temple yard and e still si pipol wey dey shange money, sidan near dia tabol. 15So e use koboko wey e make, take drive dem with dia sheep and melu komot from di temple yard. E trowey di tabol wey di pipol dey take shange money and dia money kon skata. 16E kon tell di pipol wey dey sell dove, “Make una karry all dis tins komot for here. Make una nor turn my Papa house to market.”
17Den en disciples kon remember as den rite for Psalms Book sey, “Di love wey e get for en Papa house dey burn for en heart like fire.”
18Di Jew oga dem kon ask am, “As yu dey do all dis tins, na wish sign yu go show us make wi for fit bilive yu?”
19Jesus ansa dem, “Even if una distroy dis Temple, for three days time, I go build am again.”
20Den di Jew oga dem tell am, “Na forty-six years dem take build dis Temple and yu dey sey yu go fit build am for three days?” 21But na di temple for Jesus body naim e dey tok about. 22So wen Jesus don wake-up from deat, en disciples kon remember sey, e tok so before. Den dem kon bilive wetin dem rite for God word and wetin Jesus tell dem.
Jesus Go Di Passova Feast
23Jesus dey for Jerusalem by di time wey dem dey do di Passova Feast. For der, many pipol kon bilive am, bikos dem si di mirakles wey e do. 24But Jesus nor gri open en mind give di pipol, bikos e know dem well-well. 25E nor nid anybody to tok about am, bikos e know wetin dey inside pipol belle, so e nor fit trust dem.

Currently Selected:

John 2: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

YouVersion uses cookies to personalize your experience. By using our website, you accept our use of cookies as described in our Privacy Policy