YouVersion Logo
Search Icon

Jenesis 11

11
Babilon Towa
1From di biginnin wen di world start, evribody dey speak only one language. 2As dem skata go di east side dem kon rish one place wey dem dey koll Shinar kon stay for der. 3Den dem tell each oda sey, “Make wi do stone kon bake dem make dem for strong well-well.” So dem do strong stone wey dem go take build. 4Den dem sey, “Naw, make wi build one town wey go high rish di sky, so dat wi go make name for awasef, if not, wi go skata for evriwhere for di eart.”
5Den Oga God kom down kon si di town wey doz men dey build, 6so E kon sey, “If dem dey do dis as pipol wey dey speak one language, den nor-tin go stop dem for anytin wey dem won do. E nor go tey before, dem go fit do anytin wey dem wont! 7So make wi go down go skata dem kon mix dia language, so dat dem nor go undastand each oda.”
8So di Oga God skata dem for evriwhere for di eart and dem kon stop to build di town. 9Dat na why dem koll di town, Babel, bikos God give dem difren language and from der, E skata dem for evriwhere for di world.
Shem Family
10Dis na Shem shidren.
Two years afta di rain, wen Shem don rish hundred years, e kon born Arfaxad. 11Afta e born Arfaxad, Shem stay for five hundred years and e born oda sons and dotas.
12Wen Arfaxad na thirty-five years, e kon born Shelah. 13Afta Arfaxad don born Shelah, e stay for 400 and three years and e born oda sons and dotas.
14Wen Shelah na thirty years, e born Eber. 15Afta e born Eber, Shelah stay for 400 and three years and e born oda sons and dotas.
16Wen Eber na thirty-four years, e born Peleg. 17Afta e born Peleg, Eber stay for four hundred and thirty years and e born oda sons and dotas.
18Wen Peleg na thirty years, e kon born Reu. 19Afta e born Reu, Peleg stay for two hundred and nine years and e born oda sons and dotas.
20Wen Reu na thirty-two years, e kon born Serug. 21Afta e born Serug, Reu stay for two hundred and seven years and e born oda sons and dotas.
22Wen Serug na thirty years, e kon born Nahor. 23Afta e born Nahor, Serug stay for two hundred years and e born oda sons and dotas.
24Wen Nahor na twenty-nine years, e kon born Terah. 25Afta e born Terah, Nahor stay for one hundred and nineteen years and e born oda sons and dotas.
26Wen Terah na seventy years, e kon born Abram, Nahor and Haran.
Terah Family
27Dis na Terah shidren-shidren. Terah born Abram, Nahor and Haran. And na Haran bi Lot papa. 28Haran die for di land wey dem for born am, inside Ur for Kaldea, wen en papa Terah still dey alive. 29Abram and Nahor kon marry wife. Abram wife name na Sarai and Nahor wife name na Milka wey bi Haran pikin and Haran na still Iskah papa too. 30But Sarai nor fit get belle; so e nor get pikin.
31Terah kon karry en pikin Abram, en grand-pikin Lot and en pikin wife Sarai, dey follow body go Ur for Kaldea, so dat dem go-go Kanaan. Wen dem rish Haran, dem kon stay for der. 32Di total life wey Terah live na two hundred and five years, den e kon die for Haran.

Currently Selected:

Jenesis 11: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

YouVersion uses cookies to personalize your experience. By using our website, you accept our use of cookies as described in our Privacy Policy