Exodus 30
30
Ofrin Altar
1“Yu go take akasia wood take make altar to burn incense. 2E go long rish one fit and half and na so too e go wide rish; e go bi four korna. En horns go bi three fit for di four korna wey bi di same wood as di altar. 3Yu go kover di top; all di four side and en horns wey bi pure gold, den kon take gold round am. 4Yu go make two gold ring under di borda for di two side, so dat e go hold di poles wey dem go take karry am. 5Yu go take akasia wood take make poles kon kover dem with gold. 6Den make yu put di incense altar for di front of di curtain wey dey di Testimony Box front (before di sakrifice place wey dey on-top di Testimony Box), where I go for meet yu. 7Evry morning wen Aaron kom prepare di lamp, e go burn sweet incense for di altar. 8And evry evening wen e lite di lamp, e must still burn incense for God present. Dem go dey do dis tin from one generashon go rish anoda. 9Make yu nor burn incense wey nor holy for di altar or any bad animal, korn or even pour drink ofrin on-top di altar. 10Wons evry year, Aaron go klean di altar with blood from di horn and dem go dey do like dis from one generashon go rish anoda, bikos e dey holy to Oga God.”
Tabanako Money
11God kon tell Moses, 12“Wen ever yu dey kount Israel pipol akordin to dia nomba, anybody wey dem kount go pay for en life to di Oga dia God, so dat bad tin nor go happen to dem wen yu dey kount dem. 13Anybody wey dem kount go give small silva as holy ofrin to Oga God. (Di amount na half shekel wey bi twenty gerah.) 14Doz wey don rish twenty years, must give dis holy ofrin to God. 15Wen una one give dis ofrin to God, so dat una go dey rite with am, rish pipol and poor pipol go pay di same tin. 16Yu go kollect dis money from Israel pipol kon use dem take maintain di Tabanako. Bikos of dis, Israel pipol go always dey Oga God mind and E go klean una life.”
Di Bronze Basin
17God tell Moses, 18“Yu go still make bronze basin with bronze stand. Yu go put wota inside am kon put am between di tent wey dem for dey do meetin and di altar. 19Aaron and en sons go use di wota take wosh dia hand and leg. 20Wen ever Aaron and en sons dey enter di Tabanako go meet God or to go burn ofrins, dem must wosh demsef with wota, so dat dem nor go die! 21Dem must always dey wosh dia hand and leg, so dat dem nor go die. Dis law na for dem and dia shidren forever.”
Di Anointin Oil
22Den God tell Moses, 23“Make yu selet betta spices like: twelf and half pounds of pure myrrh, sinamon wey get betta smell and make e bi six and one kwota pounds, sugarcane go bi six and one kwota pounds, 24twelf and half pound of kassia and una go measure dem as dem dey measure di Tabanako shekel. Yu go still bring one gallon of olive oil. 25Di anointin oil wey dem mix like perfume, go dey holy and dem go dey use am for God work. 26Yu go use di oil take anoint di tent where dem for dey do meetin, di Testimony Box, 27di tabol and all en material; di lampstand and wetin follow am, di incense altar, 28di burnt ofrin altar and evry oda tin, di basin and en lampstand. 29Den yu go santify dem and dem go dey holy. Anytin wey tosh dem go dey holy too. 30Yu go anoint and santify Aaron and en sons, so dat dem go fit serve as my priest. 31Make yu tell Israel pipol, ‘Una go always dey use dis holy anointin oil anytin una dey do God work. 32Make una nor rub am for pipol body and make una nor make any oda oil wey bi like am. E dey holy and e must dey holy to una. 33Anybody wey make perfume like am or take am rub strenja, dem go drive am komot from di kommunity.’ ”
Di Incense
34God kon tell Moses, “Make yu take spices like: gum, resin, onyx, galbanum and pure frankincense and dem go bi di same amount. 35Use dem take make incense wey dem mix with perfume. E must dey smooth, pure and holy. 36Yu go grind some to powder, den put some for di Testimony Box wey dey inside di tent where dem for dey do meetin; di place where I go for meet yu. Na-im must dey holy pass to yu. 37And yu must nor make dis kind perfume for yorsef, bikos dis one na for God and e must dey holy to yu. 38Anybody wey make anytin like am, dem go drive am komot from di kommunity.”
Currently Selected:
Exodus 30: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: