Exodus 29
29
Dem Make Aaron Priest
1“Dis na how yu go take dedikate Aaron and en sons as my priest. Yu go take one yong melu and two ram wey dey okay. 2Den make bread wey nor get yist; kake wey dem mix with olive oil and biscuit wey dem rub with oil kon 3put all of dem inside one basket with di melu and di two ram.
4“Yu go bring Aaron and en sons near di door-mot for di tent where dem for dey do meetin kon wosh dem with wota. 5Di garment wey bi tunik, di priest garment dress, di main priest garment and di breast plate, yu go wear dem for Aaron. Yu go use waistband wey dem weave well-well, take tie di priest garment for en body. 6Make yu put di priest kap for en head and di holy crown go dey on-top di priest kap. 7Yu go pour and anoint am with di anointin oil. 8Den yu go bring en sons kon wear di tunik for dem. 9Put sash round dia waist kon wear head-band for dem, so dat dem go serve as priest, just as God kommand dem. Na so yu go take klean Aaron and en sons.
10“Make yu bring di melu kom di tent front where dem for dey do meetin, den Aaron and en sons go put dia hand on-top di melu head. 11Dem go kill di melu for where God dey for di tent door-mot where dem for dey do meetin. 12Yu go take some of di melu blood with yor finger kon put am for di altar horn, den yu go pour di remainin blood under di altar. 13Di fat wey dey inside di intestine; di part wey dey di liver top; di two kidney and dia fat, make yu take dem follow Aaron and en sons, den yu go burn dem for di altar. 14But di melu flesh, en skin and en shit, yu go-go burn dem outside di kamp. 15Yu go take one ram kon sey make Aaron and en sons go put dia hand on-top en head. 16Den yu go kill di ram kon rub en blood round di altar. 17Den yu go kut di ram into pieces, wosh di intestine and en two legs kon put dem on-top en head and di oda part. 18Yu go burn all di ram for di altar. Na burnt ofrin to God and Oga God like di smell well-well; bikos na ofrin wey dem make with fire. 19Yu go take di sekond ram, den Aaron and en sons go put dia hand on-top en head. 20Den yu go kill-am, take some of en blood put for di korna for di sons rite ear, di first big finger for dia rite hand and di big toe for dia rite leg, den sprinkol di blood round di altar. 21Make yu take some blood wey dey di altar and some anointin oil, den sprinkol dem for Aaron and en sons body, so dat Aaron and en sons with dia garments, go dey holy.
22“Since dis na di ram to take santify Aaron and en sons, yu go remove di fat for di tail, di fat for di intestine; di fat for di liver and di fat for di kidney. Yu go still remove di fat for di rite leg from di knee go up. 23Make yu take one bread wey get olive oil; anoda one wey nor get and one biscuit from di bread basket wey dem give di Oga awa God. 24Yu go put all dis tins for Aaron and en sons hand kon karry dem as special ofrin go give awa God. 25Den yu go take di bread from dia hand kon burn dem for di altar as ofrin wey get betta smell to God. 26Di ram wey yu use take klean Aaron, make yu take di breast kon karry am as betta ofrin to God and e go bi yor share.
27“Make yu keep di part for di ram wey bilong to Aaron and en sons and na di breast and di lap wey dem karry give God as holy ofrin. 28Anytin Israel pipol give God as dia peace ofrin, go bi Aaron and en sons share and nobody go shange dis law.
29“Dem go take Aaron holy garment give en pikin afta en don die, so dat dem go anoint and make di pikin dey klean. 30Anybody wey go take-ova from Aaron as priest among en sons, go wear di garment for seven days as e dey serve for di Tabanako and di Holy Place.
31“Yu go take di ram kon kook en flesh for di Holy Place. 32Aaron and en sons go chop di ram meat and di bread wey dey inside di basket for di door-mot for di tent where dem for dey do meetin. 33Na dem go still chop di bread and meat wey dem take klean and santify dem. No oda pesin go chop from dem, bikos di food dey holy. 34And if any of di ofrin meat or di bread remain till morning, den yu go burn wetin remain with fire. Nobody must chop am, bikos e dey holy.
35“Yu go anoint Aaron and en sons for seven days, just as I kommand yu. 36Evriday, yu go prepare one melu as sin ofrin to klean dem. Yu go make sakrifice for di altar to klean am and yu go anoint and santify am. 37For seven days, yu go make sakrifice for di altar kon santify am, den di altar go dey holy and anytin wey tosh di altar, go dey holy too.
Evriday Ofrin
38“Naw, dis na wetin yu go prepare for di altar evriday: two lamb wey bi one year old. 39Yu go prepare one among di lamb for morning and di sekond lamb, for evening. 40Dis na di tin wey yu go offa give mi with di first lamb: yu go offa am with di Tabanako efah wey get fine flower wey dem mix with one kwota of oil wey dem press komot from some olives and one kwota of wine as drink ofrin. 41Den di sekond lamb wey yu go offa for evening; yu go prepare am like di morning own, with drink ofrin wey get betta smell; ofrin wey dem make with fire for God.
42“Dis one go bi burnt ofrin for God and dem go dey do am evritime for di Tabanako door-mot where dem for dey do meetin thru-out una generashon; bikos na dat place I go for meet and tok to yu. 43I go meet Israel pipol for der too, bikos my present wey karry glory don make am holy. 44I go santify di tent where dem for dey do meetin, di altar, Aaron and en sons, so dat dem go fit serve mi as priest. 45I go stay with Israel pipol and I go bi dia God. 46Den dem go know sey na mi bi dia God, wey take dem komot from Egypt, so dat I go fit stay with dem. Na mi bi di Oga wey bi dia God.”
Currently Selected:
Exodus 29: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: