Exodus 17
17
Wota Kom Out From Rock
1Israel pipol kon start to travel from Sin Wildaness, just as Oga God kommand dem. Dem stay for Refidim, but di pipol nor si wota to drink for der. 2So dem komplain give Moses, “Make yu give us wota drink!”
Moses ansa dem, “Wetin make una dey kworel with mi? Why una dey test God?”
3But di pipol dey hongry to drink wota, so dem still komplain, “Wetin make yu take us komot from Egypt? Na to kill wi, awa shidren and awa animals with honga?”
4Den Moses kry to God, “Wetin I go do with dis pipol? Bikos if e worse pass like dis, di pipol go stone mi die!”
5God tell Moses, “Take some among di eldas for Israel, with yor stik wey yu take nak River Nile, den make yu lead di pipol. 6I go stand wait yu on-top one rock for Horeb. Wen yu rish der, make yu nak di rock and wota go kom out for di pipol to drink.” Moses do as God kommand am and di eldas for Israel si evritin wey e do.
7Moses koll di place Massah and Meribah, bikos Israel pipol komplain and test God wen dem sey, “Yu sure sey, ‘God dey with us?’ ”
War With Amalek Pipol
8Amalek pipol kon attack Israel pipol for Refidim. 9So Moses tell Joshua, “Make yu go choose some men for us, so dat una go-go fight Amalek pipol. Tumoro, I go stand on-top di hill with God stik for my hand.”
10So Joshua fight Amalek pipol just as Moses tell am, den Moses, Aaron and Hur kon go top of di hill. 11Anytime Moses karry en hand go up, Israel pipol go dey win, but wen e bring en hand kom down, Amalek pipol go dey win. 12Wen Moses hands don taya am, Aaron and Hur gi-am stone make e sidan, den dem kon hold en hand; one pesin for di rite and anoda pesin for di left. So en hand kon dey up until evening. 13Like dis, Joshua win Amalek pipol and dia sojas.
14Den God tell Moses, “Make yu rite dis tin for groun, so dat pipol go remember am, den tell Joshua sey, mi wey bi Oga God go make sure sey Amalek pipol nor go dey dis world again.” 15So Moses build one altar kon koll am, “Na di Oga God bi my banner,” 16bikos e sey, “Dem karry dia hand face God throne, so dat God go dey fight Amalek pipol forever.”
Currently Selected:
Exodus 17: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee