Anytime Moses karry en hand go up, Israel pipol go dey win, but wen e bring en hand kom down, Amalek pipol go dey win. Wen Moses hands don taya am, Aaron and Hur gi-am stone make e sidan, den dem kon hold en hand; one pesin for di rite and anoda pesin for di left. So en hand kon dey up until evening.