Exodus 14
14
Israel Pipol Cross Di Red Sea
1Den God tell Moses, 2“Make yu tell Israel pipol sey make dem go stay for Pi Hahirot wey dey between Migdol and di Red Sea opposite Baal Baal-Zefon. 3Fero go tink sey Israel pipol konfuse kon dey waka up-and-down for di wildaness. 4I go make Fero heart strong again and e go porshu una and una go honor mi, bikos of wetin I go do Fero and en sojas, den Egypt pipol go know sey na mi bi Oga God.” So Israel pipol do as Moses tell dem.
5Wen dem tell Fero sey Israel pipol don go, en heart and en savants heart kon turn against Israel pipol. So dem sey, “Wetin even make us do dis tin? Naw wey wi don free Israel pipol, na who go kon dey serve us?” 6Di king kon ready en and en sojas shariot. 7Den e take six hundred of en best shariot and all di horse for Egypt and di sojas wey go ride dem. 8God make Fero heart strong well-well, so e kon porshu Israel pipol. Naw Israel pipol just komot Egypt with betta mind. 9Egypt sojas porshu dem with all dia shariot and Fero shariot and dem katch Israel pipol for dia kamp for Pi Hahirot and Baal Baal-Zefon wey dey near di Red Sea near.
10Israel pipol look up kon si Fero and Egypt sojas dey mash kom meet dem. Fear katch dem, so dem shaut kon kry to God.
11Den di pipol tell Moses, “Na bikos grave nor dey Egypt, naim make yu bring us kom inside dis wildaness, so dat wi go die for here? Na wetin make yu karry us komot from Egypt? 12Wi tell yu for Egypt sey, ‘Make yu leave us as wi dey serve Egypt pipol! E for betta sey wi dey serve Egypt pipol, dan to kom die inside dis wildaness o-o!’ ”
13Moses kon tell di pipol, “Make una nor fear! Make una get faith and una go si how God go take save una; bikos dis Egypt sojas wey una dey si today so, una nor go ever si dem again. 14God go fight for una, so make una nor worry.”
15Den Oga God tell Moses, “Wetin make yu dey kry to mi? Tell di pipol make dem move go front. 16But make yu yorsef raiz yor stik kon take am divide di Red Sea, so dat Israel pipol go waka pass for dry groun. 17But I go make Egypt sojas heart strong, so dat dem go porshu una and pipol go honor mi, bikos of wetin I go do to Fero, en shariot and doz wey dey ride dem. 18Den Egypt pipol go know sey na mi bi God wen I don kollect my glory for wetin I go do Fero, en shariot and doz wey dey ride dem.”
19God angel wey dey lead Israel pipol kon go dia back and di kloud move komot from dia front go dia back. 20Di kloud dey between Egypt pipol kamp and Israel pipol own. Di kloud make evriwhere dark for Egypt pipol, but give lite to Israel pipol, so dem nor fit near each oda till day break.
21So Moses stresh en hand face di sea and God kon divide di sea with strong breeze for nite, den di wota turn to dry land. 22So Israel pipol waka pass di sea for dry groun; di wota kon form wall for dia rite and left side. 23All Fero shariot and doz wey dey ride dem kon porshu Israel pipol enter di Red Sea for dry land. 24As day won break, God look Egypt sojas thru di fire and di kloud kon make dem konfuse. 25E make dia shariot taya sink and dem nor fit ride fast, den Egypt sojas kon sey, “Make wi run go back from dis pipol, na God dey fight us bikos of dem.”
26God kon tell Moses, “Make yu stresh yor hand face di sea, so dat di wota go fall kon kover all Egypt sojas, dia shariot and doz wey dey ride dem.” 27So Moses stresh en hand face di sea and wen morning rish, di sea don go back to di way e bi before. For dis time, Egypt sojas try to run from di wota, but God kill all of dem inside di sea. 28Di wota fall kover di shariot with doz wey dey ride dem and all Fero sojas wey porshu Israel pipol enter di sea, kon die.
29But Israel pipol waka pass di sea for dry groun and di wota form wall for dem, both for dia rite and left side. 30So for dat day, Oga God save Israel pipol from Egypt pipol hand. Leta, Israel pipol kon si Egypt pipol dead body for di wotaside. 31Wen Israel pipol si how di Oga dia God take fight Egypt pipol with en mighty pawa, dem kon dey fear am. So, dem kon bilive God and en savant, Moses.
Currently Selected:
Exodus 14: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee