Efesians 6
6
Shidren
1Shidren, as una know God, make una dey hear una papa and mama word, bikos na wetin una suppose do bi dat. 2Make una respet una papa and mama, bikos na dis bi di first kommandment from God wey get promise. 3So dat e go betta for una and una go get long life.
4Una wey bi papa, make una nor make una shidren vex, but make una raiz dem to follow Christ tishing.
Savant And Masta
5Una wey bi savant, make una dey obey una masta with fear, respet and with klean mind like sey, na Christ una dey obey. 6Make una nor bi like pipol wey dey do dia work wen dem si sey, pesin dey look dem; bikos dem dey fine good face. Instead, as una bi Christ savant, make una dey do wetin God like from una heart. 7Make una dey do una work with betta mind like sey, na Christ una dey do am for and nor bi human being, 8bikos una know sey, each pesin; weda e bi slave or e dey free, if e do wetin dey good, Christ go reward am.
9And una wey bi masta, make una dey trit una savant well. Make una nor make dem fear, bikos both yu and dem get di same masta for heaven and E nor dey favor pesin anyhow.
Spiritual Fight
10Finally, make una dey strong with Christ mighty pawa. 11Make una wear komplete soja uniform wey God dey give, so dat una go fit stand fight di wayo wey devil dey use. 12Bikos, wi nor dey fight against human being, but na against di wiked rulers wey dey for dis world, against evil spirits and pawas wey dey di heavens. 13Na dis make mi sey, make una wear komplete soja uniform wey God dey give, so dat una go fit stand for groun wen trobol and wahala go kom and wen una don win, una go still stand well. 14So, make una stand well-well kon tie trut like belt round una waist, den wear bullet proof koat as raitiousness for una body. 15Make una wear shoe for leg wey go show sey, una dey ready to prish di Good News wey dey give pipol peace 16and with all dis, make una karry faith wey go help una kwensh all di wiked arrows wey Satan dey trow. 17Make una wear salvashon like priest kap for head kon whole di Spirit swod wey bi God word. 18With difren prayers, make una dey ask God to help una. Make una always dey pray with di Spirit and dey shine una eyes well-well. Make una nor give up, but make una kontinue to pray for all God pipol. 19Make una pray for mi too sey, make God give mi betta word anytime wen I open my mout to tok and make I fit esplain di sekret wey dey di gospel. 20I bi God messenja, even doh I dey for prison naw. But make una pray sey, I go dey tok with boldness as I suppose to tok.
Last Message
21Tikikus wey bi my special broda and faithful savant for God work, go tell una evritin, so dat una go know wetin dey happen to mi for here. 22Na bikos of dis I send am kom meet una, make una for know how tins dey with us for here and make e for fit enkourage una heart.
23I pray sey make God, awa Papa and Oga God Jesus Christ give all my fellow Christian brodas and sistas peace, love and faith. 24Make God grace dey with evribody wey love awa Oga God Jesus Christ with di love wey nor dey die.
Currently Selected:
Efesians 6: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: