Efesians 5
5
Love One Anoda
1So, make una dey bihave like shidren wey God love well-well. 2Make wi love one anoda, just as Christ love and sakrifice ensef as ofrin wey get betta smell to God, bikos of us. 3To dey sleep with pesin wey yu nor marry; dey do tins wey nor dey pure and get long-trot, make una nor allow dis tins dey among una, bikos dem nor good for God pipol. 4Make una nor allow yeye and foolish word kom out from una mout. And make una nor dey tok anyhow or use bad word, bikos all dis tins nor good. Instead, make una dey tank God with una mout. 5One tin wey una must know bi sey, pesin wey dey sleep with who e nor marry; wey nor dey pure or wey get long-trot and dey serve juju, nor go enter Christ and God kingdom.
God Lite
6Make una nor let anybody deceive una with yeye word, na dis tins make God dey vex for doz wey nor dey obey am. 7So make una nor join dem. 8Before-before, una dey for darkness, but naw, una bi lite wey dey shine inside Christ. So make una dey do tins like shidren wey get lite, 9bikos di fruit wey lite get, dey bring goodness, raitiousness and trut. 10So, make una always dey do tins wey go make God happy. 11Make una nor put hand for bad tins, instead, make una dey espose dem. 12Shame nor go let wiked pipol tok about wetin dem dey do for sekret. 13But evribody go si evritin wey kom out for lite. 14Bikos na lite dey make evritin shine kom out and na dis make dem rite sey:
“Wake-up; yu wey dey sleep!
Make yu raiz from grave
and Christ go shine for yor life!”
Live With Wisdom
15Make una dey kareful as una dey live una life. Make una nor bi like pipol wey nor get sense. 16Make una use evry shance wey una get well, bikos dis time wey wi dey so, dey evil and wiked. 17Bikos of dis, make una get sense to undastand wetin awa Oga God word tok and mean. 18Make una nor dey drink strong drink, bikos e go distroy una. But make una allow God Spirit fill una mind. 19Make una dey tok to unasef with psalms, hymns and spiritual songs. For inside una heart, make una dey praiz God with hymns and psalms. 20With awa Oga God Jesus Christ name, make una dey tank God awa papa for each oda. 21Bikos of di respet wey una get for Christ, make una dey respet one anoda.
Husband And Wife
22Una wey bi wife, make una dey respet una husband, just as una dey respet Christ, 23bikos na di husband bi di wife head, just as Christ bi head for di church and naim en save di body. 24As di church dey submit to Christ, na so too, wife suppose submit to dia husband for evritin. 25Husband, make una love una wife, just as Christ love di church kon sakrifice en life for am, 26so dat e go fit make am klean, thru baptizim and God word. 27E do like dis, so dat di church go bi like wife wey fine well-well, wey nor get any stain, dey do anyhow or get any oda tin wey fit spoil am. 28Na so too, husbands suppose love dia wife like dia own body. Man wey love en wife, love ensef. 29Nobody don ever hate e own body, but e dey feed and kare for am, just as Christ dey kare for di church, 30bikos wi bi part for en body. 31Na bikos of dis, man go live en papa and mama go join en wife and di two of dem, go bi one flesh. 32Dis sekret wey I dey tell una so big well-well, but na di tin wey dey between Christ and di church, I dey tok about. 33So, each man suppose love en own wife, just as e love ensef and evry wife suppose respet en husband.
Currently Selected:
Efesians 5: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: