Efesians 2
2
New Life
1Before-before, na sturbones and sin dey kontrol una life, 2bikos una dey do wetin di world wont. Una dey obey wiked pawas wey dey rule di air and kontrol sturbon shidren. 3All of us dey live dis kind life before. Wi dey do difren tins wey awa body and mind wont. Dat time, wi bi shidren wey God won ponish like oda sinnas.
4Bikos God love us well-well, E don show us plenty mesi 5(aldo sin dey kontrol awa life before), E kon give us life thru Christ, den E save us with en grace! 6E raiz us up with Christ kon make us sidan with am for heaven. 7E do dis, to show evribody for di world wey dey kom sey, en grace wey dey show us kindness thru Jesus Christ, big well-well. 8God save una with en grace, bikos una get faith (as una don bilive Christ), nor bi with una own pawa, but na God give una. 9E nor save una bikos of di work wey una do, so make nobody dey boast. 10God kreate us thru Jesus Christ as di good work wey E don prepare down before, so dat wi go dey do as E plan.
New Life Togeda
11Make una remember sey before-before una bi Gentile pipol wey dey do wetin di flesh wont and Jew pipol dey koll una, “pipol wey dem neva sekonsaiz” like di way dem dey sekonsaiz human being. 12Dat time, una dey without di Mezaya and una nor get share for Israel blessings and since una nor get hope and una dey without God for dis world, una kon bi strenja to God kovenant wey E promise Israel pipol. 13But thru Jesus Christ blood, una wey bin dey far, God don draw una near ensef, 14bikos na Christ bi awa peace. Na Christ make Jew and Gentile pipol bi one. E don break di wall wey divide and separate dem as enemies. 15E don kansol Jew pipol law with all en kommand and rules, so dat e go fit make Jew and Gentile pipol to bi one with am and like dis, peace go dey among dem. 16E use di sofa wey e sofa for cross take end dia kworel kon make dem one body as dem dey serve God. 17And e prish peace to una wey dey far and near, 18so dat thru am, all of us with one Spirit, go fit rish where awa Papa dey for heaven. 19So, una nor go bi strenja and pipol wey nor get share for Israel blessings again, but una go bi God shidren with all di pipol wey dey en house. 20Dis na bikos, God don build una on-top di apostles and profets foundashon and na Jesus Christ bi di nomba one stone wey God take lay di foundashon. 21Na for inside Christ di whole building for join togeda kon grow as one holy Temple for God and 22thru am, God don build una togeda as where E go dey stay thru di Spirit.
Currently Selected:
Efesians 2: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee