Ekklesiastes 8
8
Obey Di King
1Na who wise and get sense?
Na Who know di ansa to dis problem?
Wisdom dey make pesin smile
and remove vexnashon from en face.
2So since yu don promise God sey yu go dey loyal to am, den make yu obey di king kommand. 3Make yu nor rush komot from di king present; nor put yor hand for bad tin, bikos di king fit do anytin wey e like. 4Anytin wey e kommand, pawa dey follow am and nobody go fit go against or kweshon en authority.
5Di king nor go ponish pesin wey dey obey am and doz wey dey wise,
go find di way and time to do wetin dey good.
6E get time and how to do tins;
bikos di king ponishment dey strong well-well.
7True-true, nobody know tumoro
and nobody fit tell anoda pesin wetin go happen tumoro.
8Wi nor fit kontrol breeze
or tok di day wen wi go die.
Dat na one war wey wi nor fit run from
and wikedness nor go fit save doz wey dey do evil.
9All dis tins wey dey happen for dis world, I don tink about dem well-well kon si sey time dey for pesin to opress en neighbour as e like.
Against Di Law
10I si as dem beri wiked pipol with honor, but God pipol dey komot di holy town and pipol dey forget dem. All dis tins nor make sense at-all.
11Wen dem nor kwik ponish pesin wey do bad, pipol go tink sey e dey good to do bad. 12If pipol wey sin hundred times still get long life, den I know sey pipol wey dey fear God, na dia life go long pass. 13But wiked pipol nor go prosper, bikos dem nor dey fear God. Dia life go kwik finish like pesin shadow.
14E still get oda yuzles tins for dis world: Sometaims, wi dey trit good pipol like sey dem wiked, den trit wiked pipol like sey dem dey good and na dis dey yuzles pass. 15So I sey make wi dey enjoy awasef, bikos di only good tin for dis world na to dey chop, drink and enjoy awa short life. Na so wi go take enjoy di happiness and hard work wey God give us to do for dis world.
16But for day and nite, I nor dey sleep bikos I dey try to undastand wetin dey happen for dis world. 17I notis sey nobody go fit know evritin wey God dey do for dis world. Aldo wise pipol fit klaim sey dem know, but dem nor know anytin at-all.
Currently Selected:
Ekklesiastes 8: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: