Ekklesiastes 7
7
Wisdom And Foolishness
1To get good name betta pass perfume wey dear well-well and di day wen pesin die,
betta pass di day wen dem born am.
2E betta to go house where dem for dey kry
dan to go where dem for dey celebrate;
bikos evribody go die one day.
So make pipol wey still dey alive
put dis one for dia mind.
3E betta make pesin dey tink about life,
dan sey e dey laf anyhow.
Bikos to dey tink and dey kwayet,
good well-well for di heart.
4Pesin wey always dey tink about happiness, na fool,
but pesin wey get sense, go still dey tink about deat too.
Yeye Life And Wisdom
5E betta make wise pesin korrect yu
dan make fool praiz yu.
6Bikos just as shuku-shuku dey burn for fire,
na so fool life bi.
Dis one too dey yuzles.
Human being Sense
7True-true, opreshon fit turn wise man to fool,
just as bribe dey korrupt di mind.
8To finish anytin wey yu start, betta pass wen yu start am,
just as to dey patient betta pass to dey proud.
9Always dey kontrol yor tempa,
bikos vexnashon go turn yu to fool.
10Nor ever ask, “Wetin make evritin bad dis days pass as dem bi before?”
Bikos e nor dey wise to ask dat kind kweshon.
Wisdom Dey save
11Wisdom dey sweet well-well wen money dey,
bikos both wisdom and money dey good well-well for dis life.
12Wisdom and money fit give yu anytin wey yu wont for life,
but na only wisdom fit save yor life.
13Make yu asept di way God kreate tins;
abi e get who go fit strait wetin God don bend?
14Wen God give yu money, make yu tank God and enjoy am,
but wen sofa kom,
make yu know sey e still kom from God too,
bikos nobody go fit tok how tumoro go bi.
Law For Life
15I don si evritin for dis yuzles life;
good yong pipol wey kwik die before dia time
and wiked pipol wey dey get long life.
16So make yu nor dey too good or too wise,
if not e go distroy yu!
17Make yu nor dey too wiked or bihave like fool,
if not, yu fit die before yor time!
18But make yu listin to all dis warnin,
bikos anybody wey dey fear God, go dey save.
Nobody Wise
19Pesin wey wise,
strong pass ten pipol wey dey rule di town,
20bikos e nor get anybody for dis world
wey dey good well-well and nor dey sin.
21So, make yu nor listin to wetin pipol dey tok,
if not, yu go hear yor savant dey curse yu,
22bikos yu know for yor own heart too,
how many times yusef don curse oda pipol.
23I dey always try my best make wisdom
guide wetin I dey tink and evritin wey I dey do.
Den I tell mysef,
“I dey ready to learn”
but I nor fit undastand am at-all.
Human being Wisdom Get End
24Evritin wey don happen, too hard for human being to undastand;
dem too deep for us to tink about.
True Wisdom
25So I try to search evriwhere to get wisdom
and to undastand why tins dey happen di way dem dey happen
and I dey ready to prove to mysef sey,
wikedness dey stupid and foolishness dey bring madness.
26I still si sey, woman wey wont make man sleep with am,
dey set trap for am
and dis one dey wiked and bad pass deat.
Pipol wey dey obey God, go fit eskape am,
but doz wey dey sin, go enter di trap.
27Di Tisha sey: “I undastand all dis tins wen I dey try to look for ansa to evritin.
28“Wetin I dey find since, I neva still si am;
I si sey among 1,000 pipol,
na only one man dey good,
but I nor si any woman wey good among dem.
29But I still learn dis one too:
God kreate evribody make dem dey good,
but dem don dey do wiked tins as dem like.”
Currently Selected:
Ekklesiastes 7: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

:
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee