YouVersion Logo
Search Icon

Deutronomi 32

32
Moses Song
1Heavens make una listin to mi as I dey tok;
eart make una listin to di words wey I won tok so.
2Make wetin I dey tish una, fall on-top una like rain;
make wetin I dey tok bi like dew for morning.
Make my words fall like rain on-top grass
and make e bi like shawa on-top plant wey just dey grow.
3Bikos I go tok about God name
and how E dey strong!
4Na-im bi di Rock;
evritin wey E dey do dey korrect,
bikos wayo nor dey en tins.
En na God wey pesin fit bilive,
bikos E nor just dey judge pipol anyhow.
5En pipol nor dey respet or fear am;
dem nor dey bihave like en shidren
and na dis bi dia sins.
Dem wiked well-well
and na lie-lie full dia generashon.
6Dis pipol wey nor get sense at-all,
na like dis una won take pay God?
Nor bi en bi una papa wey kreate una?
Na-im kreate and make una strong.
7Make una remember as e bi before,
make una tink about di generashon wey don pass.
Make una ask una papa and una eldas
and dem go tell una evritin.
8Wen di God of all ogas give di nashons dia propaty;
wen E divide evry human being,
E give di pipol where dem go stay rish,
akordin to di nomba wey dey for heaven.
9Na God get di pipol for Israel;
na Jakob bi en special propaty.
10Na empty dirty land for wildaness E for si dem.
E dey look and guide dem for evry korna;
E dey guide dem as pipol wey E love well-well.
11Just as di eagle dey wosh en house
kon kover en shidren,
na so too God spread en feada
kon karry dem go up.
12Na God dey guide dem by ensef,
e nor get any oda god wey dey with am.
13E allow dem travel pass di high place for di land
kon chop from di plants wey dey di field.
E use honey from di rock
and olive oil from strong groun take kare for dem.
14E feed dem with milk from di animals
and with di fats wey dey lamb body.
E give dem betta ram and goat form Bashan,
plus fine-fine food.
Una don drink di wine
wey sweet pass wey dem make from grape.
Israel Sin
15But Israel pipol kon fat and wiked more-more.
Di pipol kon heavy, round and tick for body!
Dem forget God wey kreate dem;
den kon rijet di Rock wey bi dia salvashon.
16Dem make am jealous,
bikos dem dey serve juju and oda gods.
17Instead make dem sakrifice give God,
dem dey sakrifice give juju
and gods wey dem nor know;
new gods wey dem just si,
even gods wey dia grand-grand papa
dem nor know about.
18Dem don forget di Rock wey bi dia papa
and di God wey kreate dem, nor dey dia mind again.
Judgement
19So wen God si all dis tins,
E vex bikos en shidren dey disobey am.
20God sey, “I go rijet dem,
I go si wetin go happen to dem;
bikos dis generashon dey show sey dem too know
and dem nor get sense.
21Dem don make mi dey vex
for di gods wey dem dey serve;
dem don make mi dey vex well-well
with tins wey nor mean anytin:
So, I go make dem jealous doz wey nor bi human being:
I go make dem vex well-well for kountry wey nor get sense.
22Bikos my vexnashon don kause fire
and e don burn rish di part wey deep pass for di grave
kon distroy di eart and en plants,
den e skata di mountins foundashon.
23I go inkrease dia wahala,
I go use all my arrow for dia body.
24Honga go kill dem,
betta sofa go worry dem.
I go send wiked animal
and bad snakes go chop dem.
25Di swod go bring deat for outside and for inside,
fear go kill both men and wimen;
small pikin and di ones wey don big.
Oda Gods Nor Get Pawa
26“I sey, ‘I won kut dem to pieces.
I won make pipol forget dem forever.
27But I nor go like how di enemies go si am,
bikos dem nor go undastand
and dem go sey, wi too get pawa
and nor bi God do all dis tins!’ ”
28Dem bi pipol wey nor get sense
and dem nor fit undastand at-all.
29How I wish sey dem get sense and fit undastand dis tins
or know wetin go happen to dem.
30How one pesin go fit porshu 1,000 among dem
and two pipol porshu 10,000;
if nor bi sey dia Rock sell dem
and dia God give dem to dia enemies?
31Bikos awa enemies rock nor bi like awa Rock
and even awa enemies know sey na so e bi.
32Dia vine na from Sodom and Gomorrah field.
Dia grape get poizin and e bitter well-well.
33Dia wine na snake poizin
and e bad like kobra own.
34God sey, “I nor dey keep all dis tins
among di tins wey I value?
35I go revensh and pay dem back wen dem go fall,
bikos di day wen wahala go kom meet dem,
don near well-well
and dia judgement don almost full!”
36God go judge en pipol
and E go shange en plan about en savant;
wen E si sey dia pawa don vanish
and nobody remain again,
weda na slave or free pesin.
37E go sey, “Where una gods,
di rock wey una bilive sey, e go guide una,
38wey dey chop di best for una sakrifice
kon drink di wine for una drink ofrin?
Make dem raiz naw kom help una;
make dem kon save and guide una!”
God Na God
39God sey, “Na Mi, bi Mi!
And e nor get any oda god escept Mi.
I dey kill and give life,
I dey make pesin sick and heal pesin too
and nobody go fit fight mi.
40Bikos I raiz my hand go heaven kon sey,
‘As long as I dey forever,
41I go make my lite sharp like swod
and my hand go hold di judgement swod well-well;
I go revensh doz wey make mi vex
kon pay doz wey hate mi!
42I go make my arrow full with blood
and my swod go distroy pipol flesh,
doz pipol wey I katch and kill
and even di enemies oga blood!’ ”
43My pipol, make una happy,
bikos God go fight for en savant;
E go pay en enemies back
kon sorry for en pipol and dia land.
Moses Final Word
44Den Moses go with Joshua, Nun pikin kon sing all di word for di song give di pipol. 45Wen Moses don sing di song give Israel pipol, 46e kon tell dem, “All dis words wey I dey tell una today, make una keep am for una mind; una must kommand una shidren to obey all dis law and kommand. 47All dis nor bi ordinary word, but dem dey give life! Wen una obey dis word, una go get long life for di land wey una go soon cross Jordan River enter.”
About Moses Deat
48Dat same day, God tell Moses, 49“Make yu go Abarim hill kountry for Mount Nebo (where bi Moab land opposite Jeriko) den look Kanaan land wey I won give Israel pipol as dia own. 50Yu go die for dat mountin wey yu go klimb kon go join yor grand-grand papa dem, just as Aaron yor broda die on-top Mount Hor kon join en grand-grand papa, 51bikos di two of una sin against mi for Israel pipol front for Meribah Kadesh wota for Zin wildaness, wen yu nor respet mi as yu suppose to. 52Yu go si di land, but yu nor go enter di land wey I dey give to Israel pipol.”

Currently Selected:

Deutronomi 32: pcm

Highlight

Copy

Compare

Share

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in