YouVersion Logo
Search Icon

Acts 11

11
Pita Defend Wetin E Do
1Di apostles and di brodas wey dey Judea kon hear sey Gentile pipol too don receive God word. 2So wen Pita rish Jerusalem, di bilivers wey bi Jew kon bigin argue with am sey, 3“Yu go chop with pipol wey dem nor sekonsaiz.” 4But Pita tell dem evritin wey happen. E kon sey, 5“As I dey pray for Joppa I kon si vishon. For inside di vishon, I si sometin wey bi like tray dey kom down small-small from heaven, dem hold am for four korna and e kon stop for my front. 6As I look inside, I kon si animals wey get four legs, bush meat, di ones wey dey creep and difren-difren birds. 7I still hear one vois wey tell mi sey, ‘Get up Pita, kill some, make yu chop.’ 8But I ansa, ‘Oga God, I nor fit, bikos since dem born mi, I neva chop anytin wey nor dey klean.’ 9But di vois from heaven kon tell mi again, ‘Wetin God don make klean, make yu nor forbid am!’ 10Dis tin happen three times, den di tray kon go heaven back. 11Na dat same time three men wey dem send kom meet mi from Caesaria kon rish di house where wi dey stay. 12Di Holy Spirit kon tell mi sey make I follow dem go. Six brodas for Joppa follow mi go too and wi kon enter di man house. 13Di man tell us how e si angel wey stand for en house kon tell am, ‘Send pipol go Joppa go koll Simon wey dem dey koll Pita. 14Wen e kom, e go give yu di message wey God go use take save yu and yor family.’ 15And wen I start to tok, di Holy Spirit kon enter dem, just as e enter us for di first time. 16So I kon remember wetin di Oga God don use en own mout tell us before sey, ‘John use wota baptize pipol, but God go baptize una with di Holy Spirit.’ 17So my pipol, if God fit give doz Gentile pipol di same gift wey E give us afta wi bilive Jesus Christ, who I bi to stop God?” 18Wen dem hear wetin Pita tok, dem nor argue with am again, so dem kon start to praiz God. Den dem sey, “Naim bi sey God don give Gentile pipol di shance to take turn from sin kom meet am, so dat dem go get di life wey nor dey end.”
Di Church For Antiok
19All di pipol wey skata komot from Jerusalem for di time wey dem kill Stefen kon travel go far place like Foenicia, Cyprus and Antiok, dey prish give only Jew pipol. 20But some among dem wey kom from Cyprus and Sirene kon go Antiok dey tok to di Greek pipol about di Good News wey koncern Jesus Christ. 21God pawa dey with dem and many pipol wey bilive kon bigin dey follow Jesus Christ. 22Wen di pipol for di church wey dey Jerusalem hear di news, dem kon send Banabas go Antiok. 23Wen e rish der kon si how God don bless di pipol, e happy well-well kon enkourage dem sey make dem kontinue to woship God with all dia heart. 24Banabas na betta pesin, di Holy Spirit dey inside am and e get faith well-well, so many pipol kon bigin follow Jesus Christ. 25Banabas komot from der go find Saul for Tarsus 26and wen e si am, e kon take am go Antiok. Banabas and Saul stay der for one year dey tish di pipol wey dey di church and na for der dem for first koll di disciples, “Christians.”
Dem Send Help Go Judea
27For di same time, some profets kon go Jerusalem from Antiok. 28One among dem wey en name bi Agabus, get up and di Holy Spirit kon put word for en mout sey, “Heavy honga go happen for di whole world.” Dis tin happen di time wen Klaudius dey rule. 29So di disciples, evribody akordin to how e fit do rish, kon sey dem go send money go give di brodas wey dey Judea. 30Afta dem don kontribute, dem kon send Banabas and Saul go give di eldas di money wey dem gada.

Currently Selected:

Acts 11: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in