Acts 10
10
Pita Visit Kornelius
1One man wey en name bi Kornelius dey stay for Caesaria and e bi offisa for Italy soja. 2E dey holy and en and en family dey woship God. E dey help di pipol well-well and dey pray to God evritime. 3One day, around three oklok for aftanoon, e si vishon where God angel for koll am, “Kornelius.” 4Fear katch am as e dey look di angel, so e ansa, “Oga God, Wetin yu wont?” Di angel tell am, “God don hear yor prayer and si all di good tins wey yu dey do for poor pipol. 5So, send some men go Joppa make dem go koll one man wey en name bi Simon Pita. 6Di man dey stay with Simon wey dey do leda work and di house dey near di sea.” 7Wen di angel don go, Kornelius kon koll two of en house boys with one soja wey dey serve am 8and wen e don tell dem evritin wey happen, e kon send dem go Joppa.
9For aftanoon for di next day, as di men dey near di town, Pita kon go di housetop go pray, 10afta sometaim, e kon dey hongry, but di food neva ready. As e dey wait, e kon si vishon. 11For di vishon, e si sey heaven open and sometin wey bi like tray, wey dem whole for en for korna kon dey kom down small-small. 12Difren-difren animals wey get four legs and di ones wey dey creep for groun and difren birds dey inside di tray. 13Den one vois tell am, “Pita, get up, kill make yu chop.” 14But Pita ansa, “Oga God, I nor go fit, bikos yu know sey since dem born mi, I neva chop anytin wey get blood or wey nor klean.” 15But di vois tell am, “Wetin God don make klean, make yu nor forbid am.” 16Dis tin happen three times and di tray kon go back to heaven.
17As Pita still dey wonder wetin di vishon mean, di men wey Kornelius send kon rish Simon house. 18Dem ask if anybody wey bi Simon Pita dey di house. 19As Pita still dey tink about di vishon, di Holy Spirit kon tell am, “Look! Three men dey find yu. 20Make yu get up go meet dem and make yu follow dem, bikos na Mi send dem kom.” 21So Pita go down go meet di men kon sey, “Na mi bi di pesin wey una dey look for. Wetin bring una kom?” 22Dem ansa, “Kornelius, di soja offisa, wey dey do good tins and dey woship God well-well, wey all Jew pipol dey respet, na-im send us kom. One angel kommand am sey make e invite yu kom prish gi-am.” 23So Pita sey make dem enter house and e welkom dem well-well.
Di next day, e kon follow dem go and some brodas for Joppa, follow am go too. 24Afta dem don travel for one full day, dem kon rish Caesaria. Kornelius don gada all en family and friends dey wait for dem. 25So as Pita enter di kompond, Kornelius knee down for en front kon dey woship am. 26But Pita hold am kon sey, “Stand up, bikos I bi ordinary human being like yu.” 27As Pita still dey follow am dey tok wen e enter di house, e kon si sey many pipol gada dey wait am. 28E tell dem, “Una know sey di law nor allow us, wey bi Jew pipol, to visit Gentile pipol or follow dem do anytin, but God don show mi sey make I nor sey anybody nor dey klean. 29Na dis make wen una send pipol kom koll mi, I nor sey ‘No’. So make una tell mi, ‘Why una koll mi?’ ” 30Kornelius ansa, “For days ago, for dis kind time for aftanoon, as I dey pray for my house, one man wey en dress dey shine kon stand for my front. 31E kon sey, ‘Kornelius, God don hear yor prayer and E don remember all di good tins wey yu dey do. 32So make yu send pipol go Joppa go koll Simon, wey dem dey koll Pita. E dey stay as strenja with Simon wey dey do leda work, wey e house dey near di sea.’ 33So, I kon send pipol go koll yu and yu do well as yu kom. Na wi bi dis for God present, wi ready to hear wetin E sey make yu tell us.”
34Den Pita tell dem, “Naw, I don undastand sey God nor dey opress anybody, 35but for evry tribe, di pesin wey fear am and dey do wetin good, na dat pesin, E dey like. 36Una know di message wey E send to Israel pipol, wen E tok about di Good News wey dey give peace, thru Jesus Christ, di real Oga God. 37Una know wetin happen from Galilee go rish Judea afta John prish sey, 38Jesus Christ wey kom from Nazaret, na-im God give di Holy Spirit and pawa. Una still know how e do good for evriwhere kon heal pipol wey devil dey opress, bikos God dey with am. 39All of us si di tins wey e do for Judea and Jerusalem, but dem hang am for three kon kill-am. 40But God raiz am for di third day kon allow pipol si am. 41Nor bi evribody si am, but na di ones wey God don choose, wey follow am chop and drink afta e don wake-up from deat. 42E kon kommand us make wi prish and warn pipol sey, na en ensef bi di Pesin wey God choose make e judge pipol wey dey alive and di ones wey don die. 43All di profets tok about am sey, ‘Evribody wey bilive am, thru en name, God go forgive dem.’ ”
Gentile Pipol Receive Di Holy Spirit
44As Pita still dey tok, di Holy Spirit kon enter inside all di pipol wey dey hear di message. 45Di bilivers wey bi Jew wey follow Pita go Joppa kon sopraiz well-well sey Gentile pipol too, fit receive di Holy Spirit, 46bikos dem dey hear wey dem dey use difren-difren language take dey praiz God. Den Pita sey, 47“Anybody go fit sey make wi nor baptize all dis pipol wey don receive di Holy Spirit, just like us?” 48So e sey make dem baptize dem for Jesus Christ name. Den di pipol sey make e stay with dem for some days.
Currently Selected:
Acts 10: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: