2 Timoti 1
1
I Salot
1Na Paul, Jesus Christ apostle rite dis leta, bikos na so God wont am, so dat I go prish about di life wey God promise us thru Christ. 2To Timoti, my pikin wey I love. Make grace, mesi and peace dey with yu from God awa Papa and awa Oga God Jesus Christ.
Paul Tank Timoti
3Anytime I remember yu for my prayer, weda na for nite or day time, I dey always tank God wey I dey serve with betta mind, just as my grand-grand papa dem serve am. 4Wen I remember as yu take kry, e dey hongry mi to kom si yu, so dat joy go full my mind. 5I always dey remember di faith wey yu first get from yor grand-mama, Lois and from yor mama, Eunice. I dey sure sey e dey inside yu.
6Na dis make mi dey remind yu sey, make yu dey use God gift wey yu get well and yu receive dis gift afta I lay hand for yor head. 7Bikos God nor give us di spirit wey go make us fear, but di spirit wey E give us, get pawa, love and sef kontrol.
8So make yu dey proud to tok about Christ or about mi wey dey prison bikos of am and make yu use di pawa wey God give yu, take follow mi sofa for dis gospel. 9Bikos God save and koll us to live holy life. E do like dis, nor bi sey wi deserve am bikos of wetin wi do, but na so E plan am even before di world start, so dat wey go know en grace thru Jesus Christ. 10But naw, E don bring all dis plan out wen awa Oga God Jesus Christ kom dis world. E distroy deat pawa kon bring life wey nor dey end thru di gospel. 11Na dis gospel make God choose mi as prisha, apostle and tisha. 12And naim make mi dey sofa wetin I dey sofa so. But I nor dey shame, bikos I know di Pesin wey I dey serve and I dey sure sey, E go guide di tin wey I gi-am whole, until di day wey Christ go kom.
13Make yu kontinue with di word wey I tell yu kon dey do am with di faith and love wey dey inside Christ. 14Make yu guide di good tins wey God give yu thru di Holy Spirit wey dey inside us.
15Yu know sey evribody for Asia, Figelus and Hermogenes aria, don run leave mi.
16Make God show en mesi to Onesiforus family, bikos e dey always make mi happy and e nor dey shame sey I dey prison. 17Wen e kom Rome, e find mi for evriwhere until e si mi. 18For di day wen Christ go kom, make e show am en mesi! And yu know how e help mi wen I dey Efesus.
Currently Selected:
2 Timoti 1: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee