1
2 Timoti 1:7
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Bikos God nor give us di spirit wey go make us fear, but di spirit wey E give us, get pawa, love and sef kontrol.
Compare
Explore 2 Timoti 1:7
2
2 Timoti 1:9
Bikos God save and koll us to live holy life. E do like dis, nor bi sey wi deserve am bikos of wetin wi do, but na so E plan am even before di world start, so dat wey go know en grace thru Jesus Christ.
Explore 2 Timoti 1:9
3
2 Timoti 1:6
Na dis make mi dey remind yu sey, make yu dey use God gift wey yu get well and yu receive dis gift afta I lay hand for yor head.
Explore 2 Timoti 1:6
4
2 Timoti 1:8
So make yu dey proud to tok about Christ or about mi wey dey prison bikos of am and make yu use di pawa wey God give yu, take follow mi sofa for dis gospel.
Explore 2 Timoti 1:8
5
2 Timoti 1:12
And naim make mi dey sofa wetin I dey sofa so. But I nor dey shame, bikos I know di Pesin wey I dey serve and I dey sure sey, E go guide di tin wey I gi-am whole, until di day wey Christ go kom.
Explore 2 Timoti 1:12
Home
Bible
Plans
Videos