2 Samuel 8
8
David Win En Enemies
1Afta sometaim, King David attack Filistia pipol again, e win dem kon take dia land wey bi Meteg Ammah from dia hand.
2E win Moab pipol too. E make dem liedan for groun kon divide dem group by group and for evry three group, e kill two. So Moab pipol kon dey work and pay dia tax give David.
3David still win King Hadadeza wey Rehob bi en papa, wey dey rule Siria for Zobah wen King Hadadeza dey go take-ova Uppa Eufrates for di river aria. 4David seize 1,000 seven hundred horse-men and 20,000 sojas wey dey waka for groun. E keep like one hundred horse kon cripple di rest.
5Wen Siria pipol for Damaskus send sojas go help Hadadeza, David attack and kill 22,000 of dem. 6Den e build soja kamp for dia aria and dem kon dey pay dia tax to am. God make David win for evriwhere.
7Di gold shield wey Hadadeza take dey guide ensef, David karry am go Jerusalem. 8E still take plenty bronze from Tebah and Berotai towns wey Hadadeza dey rule.
9King Toi for Hamat hear sey David don defeat Hadadeza sojas. 10So e send Joram en pikin make e go kongratulate David for en viktory against Hadadeza wey King Toi don fight many times.
11David dedikate di silva and gold wey e bring from di nashons wey e win and dem use dem take serve God. 12E win Edom, Moab, Ammon, Filistia and Amalek pipol and e still karry tins from Hadadeza.
13David kon popula well-well afta e just kom back from where e for go kill 18,000 Edom pipol for Salt Valley.
14E build soja kamp for evriwhere for Edom and di pipol for der kon dey under en pawa. God make David win for evriwhere.
15David rule evriwhere for Israel and e make sure sey dem trit evribody well with betta mind. 16Joab wey en mama name na Zeruaya, naim dey kommand di sojas, while Jehoshafat wey bi Ahilud pikin, dey keep rekord. 17Zadok wey bi Ahitub pikin and Ahimelek wey bi Abiatar pikin, na dem bi priests. Na Seraya bi di kourt seketry. 18Benaya wey bi Jehoiada pikin, naim bi David bodyguard oga. David sons na priests too.
Currently Selected:
2 Samuel 8: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee