2 Samuel 7
7
Natan Message To David
1Den King David kon go stay en house. And God keep am save from en enemies. 2One day, e koll Profet Natan kon sey, “I dey stay dis house wey dem build with cedar, but God Kovenant Box, dey for tent!”
3Natan ansa, “Make yu do wetin dey yor mind, bikos God dey with yu.”
4But dat nite, God kon tell Profet Natan,
5“Make yu go tell David wey bi my savant sey, ‘Nor bi yu go build temple for mi wey I go stay. 6From di time wey I save Israel pipol from Egypt till naw, I neva stay for temple; na only tent I dey stay and I dey waka from one place to anoda. 7As I dey follow Israel pipol travel rish, I neva tell any leader wey I choose before sey make e use cedar build temple for mi.’
8So make yu tell David wey bi my savant sey, di Oga God sey, ‘I take yu komot from where yu dey kare for animal kon make yu rule Israel wey bi my pipol. 9I dey follow yu go anywhere wey yu dey go and I dey make yu win all yor enemies as yu dey fight. I go make evribody know yu for evriwhere, just as dem know all di big leaders for di world. 10I don choose place for my pipol Israel and I don put dem for where dem go stay and nobody go opress dem again. 11Bad pipol dey opress dem since dem kom dis land, but e nor go happen again.
I promise sey, I go make yu win all yor enemies and I go give yu many shidren. 12Wen yu die and yu don go join yor grand-grand papa, I go make one among yor shidren king and I go make en kingdom strong. 13Na-im go build temple for mi and I go make sure sey en kingdom go dey forever. 14I go bi en papa and e go bi my pikin. Wen e do wrong, I go ponish am as papa dey ponish pikin. 15I nor go take my love and favor from am just as I take am from Saul, wey I remove so dat David go bi king. 16En house and kingdom go dey before mi forever; en family go rule forever.’ ”
17Profet Natan tell David evritin wey God show am.
David Tank God
18Den David enter Tabanako sidan kon bigin pray sey,
“My Oga God! Mi and my family nor rish who Yu go do all dis good tins for. 19But Yu dey even do di ones wey pass dem. Yu don promise my shidren-shidren tins for many years wey dey kom and Yu, Oga God don let mi si dis tins.
20Wetin I go tell Yu again? Yu know mi well-well, but Yu still dey respet mi wey bi yor savant. 21Bikos of yor promise and as Yu wont am, na-im Yu take do dis tins kon show mi wey bi yor savant.
22Oga God! Yu dey great! Nobody bi like Yu. Na only Yu bi God. Wetin wi don hear, na true! 23No kountry for dis world bi like Israel wey Yu komot from slave kon make dem yor pipol. Di big tins wey Yu do for dem, make pipol know yor name for di whole world. Yu save yor pipol from Egypt, plus di juju and gods wey dey der. 24Yu don make Israel pipol yor own forever and Yu, my Oga, don bi dia God.
25Naw, my Oga God, make Yu do wetin Yu promise my shidren-shidren and wetin Yu sey Yu go do. 26Dem go know yor name and pipol go tok forever sey, ‘God Almighty na Israel pipol God’ and Yu go always dey protet my kingdom.
27Oga God Almighty wey bi Israel pipol God! I dey pray dis prayer with all my heart, bikos Yu don show mi yor savant, all dis tins kon promise mi sey, ‘Yu go make my shidren-shidren king forever.’ 28Oga God wey get pawa, Yu bi God and Yu dey always do wetin Yu promise. 29I sey make Yu bless my shidren-shidren; make dem enjoy yor favor forever. God wey get pawa, don promise dis tin and yor blessing go dey with my shidren forever.”
Currently Selected:
2 Samuel 7: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee