2 Samuel 3
3
1Di fight between David and Saul family tey well-well. As David pipol dey strong evriday, Saul pipol kon dey weak more-more.
David Shidren
2Di shidren wey dem born for David for Hebron na:
Amnon, wey en mama na Ahinoam, wey kom from Jezrel;
3Kileab wey en mama na Abigail wey bi Nabal wife before and e kom from Karmel;
Absalom wey en mama name na Maaka, wey bi King Talmai girl pikin for Geshur;
4Adonijah, wey en mama name na Haggit;
Shefataya wey en mama name na Abital;
5Itream, wey en mama name na Eglah.
Dem born all dis shidren give David for Hebron.
Abner Join David
6As David men and Saul men kontinue to dey fight, Abner kon popula and get pawa well-well for Saul pipol side. 7One day, Ish-Boshet wey bi Saul pikin kon sey Abner dey sleep with Rizpah wey bi Aiaya pikin wey bi Saul girl-friend.
8Di tin make Abner vex well-well and e kon sey, “Yu tink sey I go betray Saul? Yu tink sey na Judah I dey serve? I always dey respet Saul wey bi yor papa, en broda and en friend and I make sure sey David nor win una. But today, yu sey I dey sleep with yor papa girl-friend! 9Make God ponish mi Abner, If I nor help David get wetin Oga God don promise am. 10God go take di kingdom from Saul and en shidren-shidren kon make David king ova Judah and Israel pipol go rish Dan and Beersheba. 11Ish-Boshet kon dey fear Abner sotey, e nor fit tok one word.”
12Abner kon send messenjas go meet David wey dey Hebron dat time sey, “Who go rule dis land? Make yu make agriment with mi and I go bring Israel pipol kom yor side.”
13David ansa, “Okay! I go make agriment with yu for one kondishon; yu must bring Mikal wey bi Saul dota, anytime wen yu dey kom meet mi.” 14David still send messenjas go meet Ish-Boshet sey, “Make yu give mi my wife Mikal back, bikos I pay one hundred Filistia pipol skin to take marry am.”
15So Ish-Boshet kollect am from Paltiel wey bi Laish pikin. 16Paltiel kry follow am go rish Bahurim town. But Abner sey, “Make yu dey go yor house.” So e kon go.
17Abner go meet di leaders for Israel kon tell dem, “E don tey wen una wont make David bi una king. 18Naw, una shance don kom. Make una remember sey God sey, ‘I go use David my savant take save Israel my pipol, from Filistia pipol and all dia oda enemies.’ ”
19Abner still tok to Benjamin tribe kon go Hebron go tell David wetin Benjamin and Israel pipol agri to do. 20Wen Abner with twenty men kom meet David for Hebron, David do party for dem. 21Abner tell David, “My king, I go-go win Israel pipol kom give yu. Dem go take yu as king, den yu go get wetin yu dey find and yu go rule di whole land.” David kon make Abner know sey e dey save and e tell am make e dey go.
Dem Kill Abner
22Naw Joab and David ofisas dey kom back from fight with many tins wey dem karry. Abner nor dey Hebron with David again, bikos David don tell am make e dey go, sey e dey save. 23Wen Joab and en men kom, dem tell am sey Abner kom meet David and e tell am make e dey go sey e dey save.
24So Joab go meet di king kon tell am, “Wetin yu do so? Abner kom meet yu, why yu let am go like dat?” 25“Yu know sey, e kom here kon deceive yu and to know evritin wey yu dey do and anywhere wey yu dey go?”
26Wen Joab leave David, e send messenja go koll Abner and dem bring am back from Sirah well, but David nor know anytin about am. 27Wen Abner rish Hebron, Joab take am go di gate side like sey e won tok to am where nobody go hear, den e shuk Abner for belle. Na so e take kill Abner, bikos e kill Asahel wey bi en broda.
28Wen David hear wetin happen, e sey, “God know sey mi and my men hand nor dey Abner deat. 29But make di ponishment fall for Joab and en family head! For evry generashon, make one man from en family sofa sickness like leprosy; bad skin diziz; dey waka with walkin stik, make e die for war or nor si food chop!”
30Na so Joab and Abishai wey bi en broda take kill Abner, bikos e kill Asahel dia broda for war for Gibeon.
31Den, David orda Joab and en men sey make dem tear dia klot kon wear sak klot take mourn for Abner. King David follow Abner koffin for back wen dem dey go beri am. 32Na for Hebron dem beri Abner and di king with all di pipol kon dey kry for en grave.
33David sing dis song for Abner:
“Why Abner go die like fool?
34Dem nor tie en hands and legs,
but e die like pesin
wey tif kill!”
All di pipol kon kry for am again.
35For morning go rish evening for dat day, di pipol try taya make David for chop sometin, but David don promise sey, “Make God ponish mi, if I chop anytin today!”
36Dem si wetin David do and all of dem happy well-well. Di pipol like evritin wey David do. 37All di pipol for Israel and David pipol kon undastand sey, en hand nor dey for Abner deat.
38Di king tell en ofisas, “Una nor si sey one big leader die komot for Israel today? 39Even doh na mi God choose to bi king, I dey weak today, bikos dis Zeruaya shidren too sturbon for mi. Make God ponish dis tif, bikos of wetin dem do!”
Currently Selected:
2 Samuel 3: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee