2 Samuel 2
2
David Na King For Judah
1Afta dis, David ask God, “Make I go stay one town for Judah?”
God ansa am, “Yes! Yu fit go.”
David ask again, “Na wish one?”
God ansa, “Na Hebron.”
2So David go Hebron with en two wifes, Ahinoam wey kom from Jezrel and Abigail from Karmel wey bi Nabal wife before. 3E still karry en men and family go stay for di towns wey dey near Hebron. 4Den Judah men kom Hebron kon make David king for Judah.
Wen David hear sey Jabesh pipol wey dey for Gilead don beri Saul, 5e kon send some men go tell dem sey, “Make God bless una as una take honor una king kon beri am. 6Make God dey kind and faithful to una. Misef go trit una well bikos of wetin una do so. 7Make una get heart, dey strong, bikos Saul wey bi una king don die and Judah pipol don make mi dia king.”
King Ish-Boshet For Israel
8Abner wey bi Ner pikin and Saul soja oga, run with Saul pikin wey dem dey koll Ish-Boshet cross Jordan River go Mahanaim. 9Na for der Abner for make Ish-Boshet king for Gilead, Asher, Jezrel, Efraim, Benjamin and all Israel aria.
10E bi forty years wen dem make am king for Israel and e rule for two years. But Judah tribe, na David dem dey respet 11and e rule Judah from Hebron for seven and half years.
12Abner and di ofisas wey Ish-Boshet get kon komot from Mahanaim go Gibeon town. 13Joab wey en mama name na Zeruaya and David ofisas kon meet demsef for di pool for Gibeon. All of dem sidan; one set dey for one side for di pool and di oda set dey for di oda side.
14Abner kon tell Joab, “Make wi let some boys from di two side fight face-to-face.”
Joab kon ansa, “Okay.”
15So twelf men from Ish-Boshet and Benjamin tribe kon fight twelf men for David side. 16All of dem kut demsef for head, use swod shuk each oda for belle and di twenty-four men fall for groun die togeda. So dem koll dat place for Gibeon, “Swod Field.”
17Dat day, di fight kon strong well-well and David men win Abner and Israel pipol.
18Zeruaya three sons dey der wey bi, Joab, Abishai and Asahel. Asahel dey run fast-fast like deer for bush, so 19e kon dey porshu Abner, 20Abner look back kon sey, “Asahel! Na yu bi dat?”
Asahel ansa, “Yes! Na mi.”
21Abner kon sey, “Make yu stop to porshu mi, but run follow one of di sojas make yu kollect wetin e get.” But Asahel nor gri.
22Abner kon tell am again, “Make yu stop to porshu mi! Why yu won force mi to kill yu? How I go take face Joab, yor broda?”
23But Asahel nor still stop, so Abner kon trow en swod go back and e enter en belle kon kom out for en back. So Asahel fall for groun die and evribody wey rish der, kon stand dey look am.
24But Joab and Abishai bigin porshu Abner from evening till dem rish Ammah hill, near Giaya wey dey east for di side wey dey di road wey dem dey pass go Gibeon wildaness. 25Di men wey kom from Benjamin tribe kon gada round Abner on-top di hill.
26Abner koll Joab kon sey, “Na so wi go dey fight forever? Yu nor dey si sey wi nor go gain anytin, apart from wahala? Wi bi yor kountry pipol. Wen yu go tell yor men make dem stop to porshu us?”
27Joab ansa, “I use Oga God name take swear sey, if to sey yu nor tok, my men for porshu yu rish tumoro morning.”
28Den Joab blow di trumpet to take signal en men make dem stop to porshu Israel pipol. So, di fight kon stop.
29Abner and en men mash pass Jordan River Valley for nite kon cross and di next morning, dem kon rish Mahanaim.
30Wen Joab stop to porshu dem, e gada all en men kon si sey na nineteen of dem, with Asahel en broda, naim die. 31David men kill three hundred and sixty among Abner men wey kom from Benjamin tribe. 32Dem take Asahel body kon go beri am for en papa grave for Betlehem. Den Joab and en men travel for dat nite and dem kon rish Hebron di next day.
Currently Selected:
2 Samuel 2: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee