YouVersion Logo
Search Icon

2 Samuel 22

22
David Song
1David sing dis song afta God save am from Saul and en enemies:
2“Na di Oga awa God dey protet mi;
Na-im dey diliver mi.
3Na God dey protet and
save mi.
Na-im bi my shield and E dey defend mi.
E dey protet and save mi from danger.
4I go praiz God, bikos wen ever I koll am,
E dey save mi from my enemies!
5Deat dey round mi;
e bi like sey dem go soon distroy mi.
6Deat really dey around mi
and grave set trap for mi.
7Wen I dey trobol, I koll Oga God;
I koll my God make E help mi.
E hear my vois for en temple
kon listin and help mi wen I dey kry.
8Den di eart bigin shake dey fear,
di sky foundashon bigin shake too,
bikos God bin dey vex!
9Smoke dey kom out from en nose,
while fire and shako dey kom out from en mout.
10E tear di sky open kon kom down
with one black kloud for en leg.
11E dey fly with en shariot for heaven;
E dey travel with di wind.
12E kover ensef with darkness
and tick kloud wey wota full dey round am.
13Shako with fire dey kom out
for en front.
14Oga God dey bring tonda from di sky
and evritin dey hear
wen God wey get pawa dey tok.
15E shot en arrow take skata en enemies.
E use strong lite take make dem run.
16Di river dry finish
and di eart foundashon kon open
so God nor keep silent
and E kon shaut for en enemies with vexnashon.
17God kom down from heaven kon hold mi.
E draw mi komot from di wota wey deep well-well.
18E save mi from my strong enemies
and all di pipol wey hate mi,
bikos dem too strong for mi.
19Wen I dey trobol, dem attack mi,
but God protet mi.
20Bikos E dey happy with mi,
E help mi wen I dey trobol kon save mi.
21God reward mi, bikos I do wetin dey rite.
E bless mi, bikos I dey innocent.
22I don obey God law;
I neva turn from my God before.
23I don keep all en laws;
I neva disobey en kommand.
24E know sey I nor get fault
and I nor dey do bad tins.
25So E reward mi,
bikos I dey do wetin dey rite,
bikos E know sey I dey innocent.
26My Oga God, Yu dey faithful
to doz wey dey faithful to Yu
and Yu dey good to pipol wey dey good.
27Yu dey pure to doz wey dey pure,
but Yu show wikedness to wiked pipol.
28Yu dey save pipol wey dey honbol,
but Yu dey honbol pipol wey dey proud.
29Oga God! Na Yu bi my lite;
Yu don remove my darkness.
30Yu give mi pawa take attack my enemies
kon ovakom dem.
31Di tins wey dis God dey do, dey pafet.
Make wi trust en words!
E dey kover pipol
wey wont make E protet dem.
32Na di Oga bi God
and na only God dey defend us.
33Na inside God I hide put;
E dey make my road save.
34E make my foot dey save like deer
kon keep mi save for di mountin.
35E dey train mi for war,
so dat I go use di bow wey strong well-well.
36My Oga God! Yu protet and save mi;
Yu don make mi great.
37Yu keep mi, so dat dem nor go katch mi
and I nor fall.
38I porshu and defeat my enemies;
I nor stop till I distroy dem finish.
39I nak dem fall and dem nor fit stand again,
bikos I defeat dem.
40Yu give mi pawa for war
and viktory ova my enemies.
41Yu dey make my enemies run from mi
and I distroy doz wey hate mi.
42Dem dey look for help,
but nobody dey to save dem.
Dem koll God, but E nor ansa dem.
43I skata and turn dem to san.
I dey waka on-top dem like mud for street.
44Yu save mi from my own pipol wey fight mi
kon make mi dey always rule di nashons
and even pipol wey I nor know,
dey under mi.
45Doz wey kom from anoda land
dey bow for mi
and wen dem si mi,
dem dey obey.
46Anywhere wey dem hide put,
dem dey run komot der,
bikos dem dey fear.
47God go dey forever!
Make wi praiz di Pesin wey dey defend mi!
Make una tok how God wey save mi strong rish!
48E give mi viktory ova my enemies
kon put di nashons under mi.
49My Oga God! Yu save mi from my enemies
kon give mi viktory
and protet mi from wiked men.
50So, I dey praiz Yu among all di nashon;
I go sing praiz Yu.
51God dey give en king great viktory.
E dey always show love
to di pesin wey E choose
and na mi, David with my shidren-shidren
go rule forever.”

Currently Selected:

2 Samuel 22: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in