2 Samuel 16
16
David And Ziba
1Wen David don pass di hill small, e kon si Ziba wey bi Mefiboshet savant. E bring some donkey wey karry two hundred bread and some kake; one hundred fresh fruit and one leda bag wey wine full.
2David ask am, “Wetin yu won use all dis tin do?”
Ziba ansa, “Di donkey na for my king, David family, di bread and di fruit na for di men to chop and na di wine dem go drink wen dem don taya for di wildaness.”
3Di king ask am, “Where Mefiboshet, yor masta, Saul grand-pikin?”
Ziba ansa, “E dey for Jerusalem, bikos dem tell am sey Israel pipol go gi-am en grand-papa Saul, kingdom back.”
4Di king tell Ziba, “Evritin wey Mefiboshet get, don turn yor own.”
Ziba ansa, “I go always bi yor savant! Make I always dey do wetin dey good for my king eyes!”
David And Shimei
5Wen David rish Bahurim, one Saul relashon wey dem dey koll Shimei wey bi Gera pikin kom out bigin curse David. 6Shimei start to stone David, en ofisas and en bodyguards. 7Shimei curse am dey sey, “Make yu get out! I sey make yu dey go! Yu wey kill pipol! Wiked man! 8Yu take Saul kingdom and naw, God dey ponish yu for all di pipol wey yu kill for Saul family. God don give di kingdom to Absalom yor pikin. Yu don fall; yu wey dey kill pipol anyhow!”
9Abishai wey en mama name bi Zeruaya kon tell di king, “My king, why yu dey let dis dog curse yu? Make I go der go kut en head komot!”
10But di king tell Abishai and Joab en broda, “E nor koncern una. If e curse mi, bikos God tell am make e curse mi, who get di pawa to ask am why e dey curse mi?”
11David tell Abishai and all en ofisas, “My own pikin one kill mi, so why una dey sopraiz for dis man wey kom from Benjamin tribe? Na God tell am make e curse mi, so make una leave am make e dey curse. 12May bi God go si my sorrow and E go give mi some blessing wey go remove dis curse.”
13As David and en men dey waka pass, Shimei still follow dem rish di hill and e dey curse, dey trow stones and dirty for dia body. 14Di king and all en men taya well-well wen dem rish Jordan River, so dem kon rest for der.
Absalom For Jerusalem
15Absalom and Israel pipol enter Jerusalem and Ahitofel dey with dem. 16Wen Hushai, David friend wey e trust well-well si Absalom, e kon shaut, “Di king go live forever! Di king go rule us tey well-well!”
17Absalom kon ask am. “Wetin happen wey make yu nor dey loyal to yor friend David again? Why yu nor follow am go?”
18Hushai ansa, “How I go follow am, I dey follow di one wey God choose for Israel pipol. I go stay with yu. 19Even sef, na who I go serve, if nor bi my oga pikin? As I serve yor papa, na so I go take serve yu naw.” 20Den Absalom tell Ahitofel, “Naw wey wi don dey here, wetin yu advise make wi do?”
21Ahitofel ansa, “Go sleep with yor papa girl-friends wey e leave for di palis. Den evribody for Israel go know sey yor papa hate yu and doz wey dey follow yu, go kon get heart.” 22So dem set one tent for di palis roof for Absalom and for evribody present, Absalom enter kon sleep with en papa girl-friends.
23Dat time, any advise wey Ahitofel give, David and Absalom dey do as e tok, bikos dem bilive sey God dey tok thru am.
Currently Selected:
2 Samuel 16: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee