1 Samuel 16
16
Samuel Anoint David
1God tell Samuel, “Na how long yu won to dey sorry for Saul? I don rijet am as Israel king. So put olive oil for yor horn make yu dey go. I dey send yu go meet Jesse for Betlehem, bikos I don choose my king from among en sons.”
2Samuel ansa, “How I won take go? Saul go hear about am kon kill mi!”
But God sey, “Take one small animal follow body kon sey, ‘I don kom sakrifice give God.’ 3Den invite Jesse kom di sakrifice and I go show yu wetin yu go do. Yu go anoint di pesin wey I go choose.”
4Samuel kon do as God sey make e do. Wen e rish Betlehem, di eldas for di town dey fear to go meet am. So dem kon sey, “Hope yu kom with peace?”
5Samuel ansa dem, “Yes! Na peace I bring kom. I won give God sakrifice.” So e santify Jesse and en pikin kon invite dem kom di sakrifice.
6Wen den rish der, Samuel si Eliab kon sey, “True-true, na who God choose bi dis!”
7But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”
8Den Jesse koll Abinadab kom meet Samuel. But Samuel sey, “God nor choose dis one too.” 9Den Jesse koll Shammah. But Samuel sey, “God nor choose dis one too.” 10Jesse show Samuel en seven boys. But Samuel kon tell Jesse, “God nor choose any of dis ones.” 11Samuel kon sey, “Dis na all di boys wey yu get?”
Jesse ansa, “E still get di one wey small pass. E dey kare for di animals.”
Den Samuel tell Jesse, “Make yu send pesin go koll am kom, bikos wi nor go fit do anytin until e kom here.”
12So Jesse send for am. Di boy fine well-well, e strong and get fine eyes.
God kon tell Samuel, “Na en bi dis! Make yu go anoint am!”
13So Samuel take di horn wey olive oil full kon anoint di boy for en brodas front. God Spirit kon enter David body from dat day go. Den Samuel kon go Rama.
David For Saul Front
14Naw, God Spirit don komot from Saul body and God kon send one wiked spirit make e dey ponish am.
15Den Saul savant kon tell am, “Oga, si, one wiked spirit from God dey ponish yu! 16Make awa oga tell wi yor savant make wi look for anybody wey sabi play jita. Den wen ever di wiked spirit kom from God kon enter yu, e go play di jita and yu go kon dey okay.”
17So Saul tell en savants, “Make una fine one man wey sabi play di jita kom meet mi.”
18One of en savant kon sey, “I don si one of Jesse pikin wey dey Betlehem wey know how to play di jita. E dey strong and e get mind; e know book and e fine well-well, bikos God dey with am.”
19So Saul kon send pipol go meet Jesse sey, “David, yor pikin wey dey kare for di sheep, make yu send am kom meet mi.” 20So Jesse load one donkey with bread, one kontaina wey get wine and one goat kon send dem with en pikin David, go meet Saul.
21David meet Saul kon stand for en front. Saul like am well-well, so David kon dey karry en swod. 22Den Saul send pipol go tell Jesse sey, “Make David bi my savant, bikos I like am.”
23So wen ever di spirit from God enter Saul, David go play music for am. Dis go make Saul dey okay and di wiked spirit go leave am.
Currently Selected:
1 Samuel 16: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: