YouVersion Logo
Search Icon

1 Samuel 15

15
God Rijet Saul
1Den, Samuel kon tell Saul, “Na mi God send make e make yu king ova en pipol, Israel. Naw make yu listin to wetin God dey tok. 2Dis na wetin God wey dey heaven dey tok: ‘I si as Amalek pipol dey trobol Israel pipol, wen dem dey kom out from Egypt. 3So make yu go kill Amalek pipol. Yu go distroy evritin wey dem get. Nor leave anybody or anytin. Kill evribody both man, woman, yong pikin, melu, sheep, kamel and donkey.’ ”
4So Saul gada en sojas kon kount dem for Telaim: Dem bi 200,000 sojas wey dey waka with leg and 10,000 men from Judah. 5Saul kon go Amalek town, where e for hide en sojas for one river wey don dry. 6Saul tell Kenite dem (Pipol wey dia grand-grand papa dey nice to Israel pipol) wey dey stay with Amalek pipol sey, “Make una komot from der, if not I go kill una join dis pipol!” So Ken pipol kon komot from der.
7Den Saul kill Amalek pipol from Havilah go rish Shur wey dey near Egypt. 8E katch Agag, wey bi Amalek pipol king, but e kill all en pipol with swod. 9Saul and en sojas nor kill king Agag and dem nor distroy di betta tins and animals. Dem nor kill all di animals, but dem kill and distroy di tins wey nor good for di town.
10Den God tell Samuel, 11“I dey regret sey I make Saul king, bikos e don turn from mi and e nor do wetin I sey make e do.” Samuel kon vex well-well and e pray to God till day break.
12Den Samuel stand up wen day neva break well-well kon go meet Saul. But dem tell Samuel sey, “Saul don go Karmel where e dey build image for ensef. Den Samuel go Gilgal.”
13Wen Samuel meet Saul, Saul kon sey, “Make God bless yu! I don do wetin God tok.”
14Samuel kon sey, “If na so e bi, wetin kon bi doz sheep and kattle nois wey I dey hear?”
15Saul ansa, “I bring dem kom from Amalek; di sojas keep di best for di animals, so dat dem go sakrifice am to God. But wi kill evry oda tin.”
16Den Samuel tell Saul, “Wait first! Make I tell yu wetin God tok yestiday nite.”
Saul kon sey, “Make yu tell mi.”
17Samuel sey, “Even doh yu feel sey yu nor dey important, yu still bikom God pipol king. Na God choose yu as king ova en pipol. 18God send and tell yu sey, ‘Go kill all doz wiked Amalek pipol! Fight dem until yu don distroy all of dem.’ 19But, wetin make yu nor obey God? Wetin make yu pak some tins kom? Naw make yu know sey yu nor obey God and E dey vex for yu.”
20Den Saul tell Samuel, “But I don obey God! I go as E send mi. I bring Amalek king, Agag kom back, afta I don kill all of dem finish. 21But di sojas take some for di best animals and tins, so dat dem go sakrifice am to di Oga yor God for Gilgal.”
22Den Samuel sey,
“Na wish one God like pass:
to obey am or to offa ofrin and sakrifice?
E betta to obey dan to sakrifice
di best sheep gi-am.
23Bikos to go against am, bi like wen pesin chop witch
and to dey show sturbon head, bi like wen yu dey woship juju.
So bikos yu don rijet di word wey God tell yu,
en ensef don rijet yu as king.”
24Den Saul kon tell Samuel, “I don sin, bikos I nor obey God kommand and wetin yu tok. Bikos I dey fear di sojas, I kon follow wetin dem tok. 25Naw! Abeg make yu forgive mi. Follow mi go, so dat I go-go woship God.”
26But Samuel tell Saul, “I nor go-go with yu, bikos yu don rijet wetin God tok and God don rijet yu as king ova en pipol, Israel.”
27Wen Samuel turn make e dey go, Saul kon try to hold en klot korna and di klot korna kon tear komot. 28So, Samuel kon tell am, “God don tear Israel kingdom komot from yor hand today and E don gi-am to pesin wey betta pass yu! 29God wey get Israel must do wetin E tok and E nor dey shange en mind, bikos E nor bi human being wey dey shange mind.”
30Saul ansa again, “I know sey I don sin, but make yu nor disgrace mi before all dis pipol. Abeg, follow mi make wi go woship di Oga wey bi yor God.” 31So, Samuel follow Saul go and Saul kon woship God.
Samuel Kill King Agag
32Den Samuel sey, “Make una bring Amalek king, Agag, kom meet mi.” So dem bring Agag kom as e dey shake and e dey tink for en mind sey, “True-true, deat know sweet at-all!”
33Samuel kon sey,
“Just as yor swod kill pipol shidren
kon make some wimen nor get pikin again,
na so yor mama nor go ever get pikin again.”
Den Samuel kut Agag to pieces for God present for Gilgal.
34Samuel kon go Rama, while Saul go en house for Gibeah. 35Until di day wen Samuel die, Saul nor si am again. Samuel really sorry for Saul, but God regret sey E make Saul king ova Israel, en pipol.

Currently Selected:

1 Samuel 15: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in