1 Kings 2
2
David And Solomon
1Wen David won die, e koll en pikin Solomon kon advise am sey:
2“I go soon die, so make yor heart strong 3kon do evritin wey di Oga yor God kommand yu. Make yu obey en laws and kommand, just as Moses rite dem, so dat yu go prosper for evriwhere and anytin wey yu dey do. 4If yu obey dem, God go keep en promise wey E make wen E tell mi sey, ‘My shidren-shidren go rule Israel as long as dem dey obey my kommand with all dia heart and soul.’
5“E still remain one tin: yu remember wetin Joab do mi wen e kill two kommander for Israel sojas, Abner wey bi Ner pikin and Amasa wey bi Jeta pikin. E pritend kill dem like sey dem dey fight and dat time peace dey evriwhere, kon stain en belt and sandals with innocent blood. 6Yu know wetin yu go do, make yu sofa am well-well until e die.
7“But make yu dey kind to Barzillai shidren wey kom from Gilead kon kare for dem, bikos dem dey kind to mi wen I dey run from Absalom, yor broda.
8“E still get Shimei wey bi Gera pikin, wey kom from Bahurim town for Benjamin tribe. E curse mi well-well di day wey I go Mahanaim, but wen e si mi for Jordan River, I use God name take promise am sey I nor go kill-am. 9But naw, nor si am as innocent pesin. Yu bi man wey get wisdom, yu know wetin yu go do am. Make sure sey dem kill-am.”
David Die
10David die and dem beri am for David Town. 11E rule Israel for forty years kon rule seven years from Hebron and thirty-three years from Jerusalem. 12Solomon take-ova from en papa as king and God make en kingdom strong.
Adonijah Die
13Den Adonijah, wey en mama na Haggit, go meet Batsheba, Solomon mama and di woman ask am, “Dis na betta visit so?”
Adonijah ansa, “Yes! Na betta visit.” 14Den Adonijah sey, “E get wetin I won ask yu.”
Batsheba ask am, “Wetin bi dat?” 15E ansa, “Yu know sey di kingdom suppose bi my own and evribody for Israel si mi as king. But na my broda kon bi king, bikos na so God wont make e bi. 16So naw, e get one tin wey I won ask for, abeg make yu agri.”
17Batsheba ask, “Na wetin e bi?” E ansa, “Abeg, make yu help mi tell King Solomon make e allow mi marry Abishag, dat girl wey kom from Shunem.”
18Di woman ansa, “Okay, I go tok to di king for yu.”
19Batsheba go meet di king, make e for tell am wetin Adonijah tok. Di king stand up, bow greet en mama, den e sidan for en throne kon bring anoda chair for en mama make e for sidan for en rite side.
20En mama sey, “E get one small tin wey I won ask from yu. Abeg, make yu agri.”
Solomon ask, “Mama! Make yu ask and I nor go refuse.”
21Batsheba ansa, “Make yu allow Adonijah marry Abishag as en wife.”
22Di king ask, “Why yu sey make I give Abishag to am? Yu for still ask sey make I gi-am di throne too, since e bi my senior broda and Abiatar di priest and Joab dey en side!”
23Den Solomon swear with God name sey, “Make God ponish mi if I nor make Adonijah pay with en life for dis tin wey e ask for! 24God don already plant mi put for David, my papa throne; E don keep en promise and E don give mi and my shidren-shidren di kingdom. I use God name take swear sey, today-today, Adonijah must die!” 25So, Solomon orda Benaya wey bi Jehoiada pikin sey make e go kill Adonijah.
Abiatar And Joab
26Den Solomon tell Priest Abiatar, “Make yu dey go yor kountry for Anatot. Yu suppose to die, but I nor go kill yu naw, bikos na yu kare for di Kovenant Box wen yu dey with David my papa and yu follow am face all en trobols.” 27Den Solomon sey make Abiatar nor bi God priest again. So, wetin God tok for Shiloh about Eli and en shidren-shidren kon happen.
28Joab hear wetin happen (bikos na Adonijah e bin dey support, even doh e nor support Absalom). So e run go di tent for God present kon hold di altar horn. 29Wen King Solomon hear sey Joab run go di tent go stand near di altar, e send Benaya wey bi Jehoiada pikin, make e go kill-am for der.
30Benaya go di tent kon tell Joab, “Di king sey make yu kom out.”
Joab ansa, “No! I go die for here!”
Benaya go meet di king kon tell am wetin Joab tok.
31So, Solomon ansa, “Make yu do as e tok. Kill and beri am, so dat dem nor go hold mi, yu or any oda David pikin for wetin Joab do wen e kill innocent pipol. 32God go ponish Joab for doz pipol wey e kill, wey David my papa nor know about. Joab kill two innocent men wey betta pass am: Abner wey bi Israel soja kommander and Amasa wey dey kommand Judah sojas. 33Dia blood go dey for Joab and en shidren-shidren head forever. But God go make David and shidren-shidren prosper for en throne forever.”
34So Benaya go Tabanako kon kill and beri Joab for en house wey dey di wildaness. 35Di king make Benaya di sojas oga for Joab place, den e put Zadok as priest for Abiatar place.
Shimei Die
36Den di king send message go meet Shimei, “Make yu build house for yorsef here for Jerusalem kon stay and make yu nor komot di town. 37If yu ever pass Kidron Valley, yu go die and di blame go dey yor own head.”
38Shimei ansa, “Okay my king, I go do wetin yu tok,” So Shimei stay for Jerusalem for long time.
39Afta three years, two of Shimei slave kon run go meet Maaka pikin wey bi King Akish for Gat. Wen Shimei hear sey dem dey for Gat, 40e enter en donkey kon go find en slaves wey dey with King Akish. E si dem kon bring dem kom house back.
41Wen Solomon hear wetin Shimei do, 42e sey make dem go koll am kom, den e tell am, “Shebi I use God name take tell yu make yu nor komot from Jerusalem. And I warn yu sey, if yu try am, yu go die. Yu agri kon sey yu go obey mi? 43Wetin make yu nor keep yor promise? Why yu disobey my kommand?
44“Yu know all di wrong tins wey yu do David, my papa. Naw, God go ponish yu. 45But E go bless mi kon guide David kingdom forever.”
46Den di king orda Benaya and e kill Shimei.
So, Solomon kon dey kontrol evriwhere.
Currently Selected:
1 Kings 2: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee