1 Korintians 6
6
Kourt Kase
1Wen pesin nor dey gri with anoda pesin, una dey take una kase go kourt where sinnas go judge di matter, abi una dey take am go meet God pipol? 2Una nor know sey na God pipol go judge di world? And if na una go judge di world, una nor fit setol small-small matter among unasef? 3Una nor know sey wi go judge angels? Since na so, den wi suppose to judge di tins wey dey dis world! 4So, na wetin make us dey take awa kase go give judge wey nor know God? 5I dey tok like dis, so dat una go shame! So una nor get wise pesin among una wey fit judge between una wey bi Christians? 6Wetin dey make una karry unasef go meet judge wey nor know God? 7Wen una take unasef go kourt, dat mean sey all of una don luz. 8Instead, una dey play wayo among unasef!
9Una nor know sey wiked pipol nor go enter God kingdom? So make una nor fool unasef! Pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey serve juju; men wey dey sleep with oda men; 10tif; long-trot; drunkard; doz wey dey curse pipol and doz wey dey play wayo; non of dem go enter God kingdom. 11Na so some among una bi before, but naw, God don wosh una klean thru Jesus Christ name and en Spirit pawa, don make una klean for en eye.
12Some among una sey, “Wi fit do anytin wey wi wont.” But I dey tell una naw sey, nor bi evritin dey good for us. So I nor go gri make anytin kontrol mi. 13Una still dey sey, “Food dey good for awa body and awa body nid food.” But I dey tell una, “God go distroy di two of dem.” So make wi nor use awa body take do yeye tins. 14God go raiz us from deat with di same pawa wey E use take raiz Jesus. 15Una nor know sey una body na part for Christ body? So e dey good make wi put awa body for ashawo work? God forbid! 16Una nor know sey, pesin wey dey sleep anyhow with oda pipol, don bi part for di pipol body? 17So anybody wey join Christ, don get one spirit with am. 18Make una nor live ashawo life. Evry oda sin wey man dey kommit na for outside en body, but di pesin wey dey do ashawo, dey sin against en own body. 19Abi una nor know sey una body na di temple wey di Holy Spirit dey stay? So, nor bi una get unasef. 20God don pay betta prize for una, so make una honor am with una body.
Currently Selected:
1 Korintians 6: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: