YouVersion Logo
Search Icon

1 Korintians 5

5
Discipline For Church
1I don dey hear bad-bad tins about some of una. And una own even worse pass wetin doz wey nor know God dey do. Sotey man dey sleep with en papa wife. 2And shame nor even dey katch una! Una suppose to feel bad kon drive di pesin wey do dis kind tin. 3I know sey I nor dey der with una naw, but I dey with una for spirit. And I don already judge di pesin, just as I go do if I dey der. 4Wen una gada togeda for awa Oga God Jesus Christ name, I dey with una for spirit and Christ pawa dey with una too. 5So make una give dat pesin to Satan make e ponish am, so dat en sin go komot for en body and Christ go save am for di last day.
6E nor good make una dey boast! Una nor know sey, small yist wey dem put for bread, na-im dey make di whole bread raiz? 7Make una remove di old yist, den una go bi like fresh bread wey nor get yist and dat na wetin una bi. Bikos awa Passova lamb, na Christ wey dem don already sakrifice. 8So wen wi dey celebrate Passova, make wi nor do am with di old yist wey bi wikedness and bad belle, but make wi do am with di fresh bread wey nor get yist, wey bi trut and betta mind.
9For di leta wey I first rite give una, I sey make una nor make friend with bad pipol. 10But I nor dey tok about pipol wey bad, wiked, dey serve juju and get long-trot for dis world. If to sey na dem I dey tok about, den una nid to komot for dis world. 11But naw, I dey rite to una sey, pipol wey sey dem bi Christians and dem dey do bad tins, make una nor follow dem make friend. Make una nor even chop with dat kind pesin. 12Wetin go make mi judge pipol wey nor dey di church? Nor bi doz wey dey inside wi suppose to judge? 13Na God go judge doz wey dey outside, bikos en word sey, “Doz wey dey do wiked tins among una, make una drive dem komot from di church.”

Currently Selected:

1 Korintians 5: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in