But wen God awa Savior show us di kindness and love wey E get for us, E kon save us. Nor bi bikos wi do good, but na bikos of en mesi. E forgive awa sins and E make us new shidren kon give us new life thru di Holy Spirit. God give us dis Spirit for free thru Jesus Christ wey bi awa Savior. Since Christ grace don make us klean for God eye, wi don bi pipol wey dey wait for di life wey nor go end and wi dey sure sey, wi go get am.