1
Proverbs 22:6
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Make yu tish yor pikin how e go take live en life and wen e don old, e go still dey do di same tin.
Compare
Explore Proverbs 22:6
2
Proverbs 22:4
If yu obey God kon honbol yorsef, yu go get propaty, honor and long life.
Explore Proverbs 22:4
3
Proverbs 22:1
If yu nid to choose between good name and plenty propaty, make yu choose good name, bikos respet betta pass silva and gold.
Explore Proverbs 22:1
4
Proverbs 22:24
Make yu nor make friend with pipol wey get hot and bad tempa
Explore Proverbs 22:24
5
Proverbs 22:9
Do good and share yor food with poor pipol, den God go bless yu.
Explore Proverbs 22:9
6
Proverbs 22:3
Wise pipol dey si trobol dey run, but foolish pipol go run enter kon sofa pain.
Explore Proverbs 22:3
7
Proverbs 22:7
Na rish pipol dey rule poor pipol and if yu borrow money from pesin, yu go bi en savant.
Explore Proverbs 22:7
8
Proverbs 22:2
Pesin wey get plenty money and pesin wey nor get, na di same dem bi, bikos na God kreate two of dem.
Explore Proverbs 22:2
9
Proverbs 22:22-23
Make yu nor trit poor pipol anyhow bikos yu get pawa! Doz wey nor get help for kourt, make yu nor trit dem anyhow too, bikos God go judge dia kase for dem kon ponish doz wey dey treaten dia life.
Explore Proverbs 22:22-23
Home
Bible
Plans
Videos