1
Proverbs 19:21
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Pipol fit plan difren-difren tins, but na wetin God tok, go happen.
Compare
Explore Proverbs 19:21
2
Proverbs 19:17
Wen yu give sometin to poor pipol, e bi like sey God dey borrow from yu and God go pay yu evritin wey E borrow.
Explore Proverbs 19:17
3
Proverbs 19:11
If yu get sense, yu go fit kontrol yor tempa. E dey good make yu nor ansa if pesin offend yu.
Explore Proverbs 19:11
4
Proverbs 19:20
If yu dey listin to advise and dey ready to learn, yu go wise one day.
Explore Proverbs 19:20
5
Proverbs 19:23
Obey God and yu go get long life; yu go dey happy and dey save from trobol.
Explore Proverbs 19:23
6
Proverbs 19:8
Do good to yorsef kon learn evritin wey yu fit learn; den remember wetin yu learn and yu go prosper.
Explore Proverbs 19:8
7
Proverbs 19:18
Train yor pikin well wen dem still dey yong to learn; if yu nor do like dat, yu dey help dem distroy dia life.
Explore Proverbs 19:18
8
Proverbs 19:9
Anybody wey tok lie for wetin e nor know, nor go fit eskape ponishment and na di lie go kill-am.
Explore Proverbs 19:9
Home
Bible
Plans
Videos