1
Proverbs 10:22
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Wen God bless pesin, e dey get enough and nor-tin go make am regret.
Compare
Explore Proverbs 10:22
2
Proverbs 10:19
Too mush tok dey make pesin sin, but wise pesin nor dey tok anyhow.
Explore Proverbs 10:19
3
Proverbs 10:12
Na only trobol bad belle dey kause, but love dey kover evry sin.
Explore Proverbs 10:12
4
Proverbs 10:4
Lazines go make yu poor, but hard work go make yu get money well-well.
Explore Proverbs 10:4
5
Proverbs 10:17
Pipol wey dey listin if dem korrect dem go get long life, but doz wey nor dey gri sey dem dey wrong, dey waka lost.
Explore Proverbs 10:17
6
Proverbs 10:9
Pipol wey dey tok trut dey save and sikure, but wayo pipol dey waka enter trobol.
Explore Proverbs 10:9
7
Proverbs 10:27
Obey God and yu go get long life; bikos wiked pipol dey die before dia time.
Explore Proverbs 10:27
8
Proverbs 10:3
God nor go let honga kill good pipol and E nor go allow wiked pipol get wetin dem wont.
Explore Proverbs 10:3
9
Proverbs 10:25
Wen heavy breeze dey blow, e go blow wiked pipol trowey, but pipol wey dey tok trut, dey always dey save.
Explore Proverbs 10:25
Home
Bible
Plans
Videos