1
Mark 16:15
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Jesus kommand dem sey, “Make una enter evriwhere for di world go prish di gospel give evribody.
Compare
Explore Mark 16:15
2
Mark 16:17-18
Dis signs go follow pipol wey bilive: With my name, dem go drive demon komot from pipol body; dem go speak new language wey dem nor learn; dem go fit whole snake and if dem drink poizin, e nor go do dem anytin; dem go put dia hand for pipol wey nor well body and di pipol go well.”
Explore Mark 16:17-18
3
Mark 16:16
Anybody wey bilive and dem baptize am, God go save am, but anybody wey nor bilive, God go kondemn am.
Explore Mark 16:16
4
Mark 16:20
Den, di disciples go evriwhere for di aria dey prish di gospel and Jesus dey do many mirakles thru dem, so dat pipol go know sey, wetin dem dey prish, na true.]
Explore Mark 16:20
5
Mark 16:6
But e tell dem, “Make una nor fear. Una dey find Jesus wey kom from Nazaret, wey dem kill. God don raiz am from deat! E nor dey here again. Make una look di place wey dem put am before.
Explore Mark 16:6
6
Mark 16:4-5
But wen dem look, dem si sey, dem don already roll di stone komot. As dem enter, dem si one man wey wear white klot sidan for di rite side and fear kon katch dem.
Explore Mark 16:4-5
Home
Bible
Plans
Videos