Jesus ansa am, “Na dis bi di kommandment wey big pass: ‘Make una listin, Israel pipol, di Oga God, awa God na one e bi. Make una love God una Oga God with all una heart, soul and all una pawa.’ Di sekond one na, ‘Make una love una neighbour as una love unasef.’ E nor get any kommandment wey big pass dis two.”