Just like e happen for Noah time, na so Man Pikin go take kom. For Noah time, before di flood kom, pipol dey chop and drink, dey marry and dey give dia pikin out for marriage, until di day wen Noah enter di ark. Dem nor know wetin dey happen until wota kom karry dem go. Na like dat e go bi wen Man Pikin go kom.