1
Joshua 1:9
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
I dey tok again, so dat yu go dey strong kon get heart! Make yu nor fear or shake, bikos mi wey bi di Oga yor God, I dey with yu for evritin wey yu dey do.”
Compare
Explore Joshua 1:9
2
Joshua 1:8
Dis law wey God give yu must nor komot from yor mout! Yu must dey read and tink of am evriday and nite, so dat yu go fit obey evritin wey dey inside. Den yor way go dey rite and evritin go betta for yu.
Explore Joshua 1:8
3
Joshua 1:7
Make sure sey yu dey strong well-well and yu get heart! Make yu dey obey all di law and kommand wey my savant Moses give yu! Nor do dem anyhow, den yu go prosper for evritin wey yu dey do.
Explore Joshua 1:7
4
Joshua 1:5
Nobody go fit stop yu still yu die. I go dey with yu as I dey with Moses. I nor go forget or leave yu.
Explore Joshua 1:5
5
Joshua 1:6
“Make yu dey strong and get heart! Yu go lead dis pipol go win di land wey I don promise dia grand-grand papa sey, I go give dem.
Explore Joshua 1:6
6
Joshua 1:3
Anywhere yor leg tosh, I don gi-am to yu, just as I promise Moses.
Explore Joshua 1:3
7
Joshua 1:2
“My savant Moses don die. So make yu get ready to cross Jordan River! Make yu take dis pipol enter di land wey I don promise to give dem.
Explore Joshua 1:2
8
Joshua 1:1
Afta Moses, God savant don die, God kon tell Joshua wey bi Nun pikin wey bin dey help Moses sey
Explore Joshua 1:1
9
Joshua 1:4
Una land go start from di wildaness wey dey sout for Lebanon go rish di nort. E go rish di great Eufrates River for east (plus evriwhere for Siria) and from der go Mediterranean Sea for west.
Explore Joshua 1:4
10
Joshua 1:18
“Anybody wey won show sey e sturbon and e nor gri do wetin yu kommand, wi go kill-am. But make yu dey strong kon get heart!”
Explore Joshua 1:18
11
Joshua 1:11
“Make una go di kamp kon tell evribody sey, ‘Make una dey ready bikos like three days from naw, una go cross Jordan River kon bigin fight for di land wey di Oga una God won give una.’ ”
Explore Joshua 1:11