Wen Moses kon grow up, na faith make am nor gri make dem koll am Fero dota pikin. Instead of am to enjoy tins wey go make am sin, e kon choose to sofa with God shidren. E feel sey e betta make dem laf am, bikos of di Mezaya wey dey kom, instead make e dey enjoy di fine-fine tins for Egypt. E do like dis, bikos e put en eye for God reward. Na di same faith make Moses komot from Egypt and e nor fear di king vexnashon, bikos e get hope for God wey ordinary eye nor fit si.