Den dem rish Marah, but dem nor fit drink di wota wey dey dat place, bikos e bitter (na dis make dem dey koll am, Marah.)
So di pipol bigin komplain give Moses sey, “Wetin wi go drink?”
Moses kry to God and God kon show am one stik. Wen e trow am inside di wota, di wota kon dey good to drink.
So for der, God give dem laws kon try dia faith.