1
Ekklesiastes 5:2
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Make yu tink well-well before yu tok or before yu make promise give God. God dey heaven and yu dey dis eart, so make yu nor dey tok too mush.
Compare
Explore Ekklesiastes 5:2
2
Ekklesiastes 5:19
E still good wen God bless yu with money, propaty and good health wey yu go take enjoy dem. To enjoy yor work and asept di life wey God give yu, na big gift from God.
Explore Ekklesiastes 5:19
3
Ekklesiastes 5:10
Pipol wey like money, even di one wey dem get, nor dey rish dem and doz wey like propaty, wetin dem get, nor dey rish dem too. Dis kind behaviour dey yuzles too.
Explore Ekklesiastes 5:10
4
Ekklesiastes 5:1
Make yu dey kareful wen yu enter God temple, bikos to kom meet God make E tish yu, betta pass foolish sakrifice and pipol wey dey offa am, nor know sey wetin dem dey do, nor good.
Explore Ekklesiastes 5:1
5
Ekklesiastes 5:4
Wen yu promise God sometin, make yu do am kwik-kwik, bikos E nor get anytin to do with fools. So make yu do wetin yu promise.
Explore Ekklesiastes 5:4
6
Ekklesiastes 5:5
E betta make yu nor promise dan to make promise wey yu nor go fit keep or pay.
Explore Ekklesiastes 5:5
7
Ekklesiastes 5:12
Pipol wey dey work hard, dey sleep well for nite; weda dem chop small or plenty food. But pipol wey too rish, nor dey even fit sleep at-all.
Explore Ekklesiastes 5:12
8
Ekklesiastes 5:15
Just as pesin kom out from en mama belle naked, na so too e go-go back naked and e nor go karry anytin follow body.
Explore Ekklesiastes 5:15
Home
Bible
Plans
Videos