1
Ekklesiastes 1:18
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
bikos di more I dey find out, di more e dey worry mi well-well, bikos plenty wisdom dey bring plenty wahala too. So di more yu know, di more yu dey kause wahala for yorsef.
Compare
Explore Ekklesiastes 1:18
2
Ekklesiastes 1:9
Wetin don happen before, go happen again and wetin pipol don do before, dem go do am again, bikos nor-tin dey new for dis world.
Explore Ekklesiastes 1:9
3
Ekklesiastes 1:8
All dis tins dey taya pesin and nobody fit shange or tok as dem bi: No matter wetin wi dey si and hear, awa eyes still won si and awa ear still won hear more.
Explore Ekklesiastes 1:8
4
Ekklesiastes 1:2-3
Di tisha sey, “Evritin dey yuzles! Yes, evritin really dey yuzles!” Wetin pipol dey gain from all di hard work wey dem dey do for dis world?
Explore Ekklesiastes 1:2-3
5
Ekklesiastes 1:14
As I tink about evritin wey human being dey do for dis world, I kon sey: Evritin dey yuzles; e just bi like sey pesin dey porshu breeze.
Explore Ekklesiastes 1:14
6
Ekklesiastes 1:4
Wen one generashon kom, di one wey dey before go-go, but di world nor dey shange.
Explore Ekklesiastes 1:4
7
Ekklesiastes 1:11
Wi nor dey remember wetin don happen before and for di next generashon, nobody go remember wetin wi dey do naw.
Explore Ekklesiastes 1:11
8
Ekklesiastes 1:17
So I kon gri to find out wetin wisdom, madness and foolishness bi. But e klear sey, na breeze I just dey porshu
Explore Ekklesiastes 1:17
Home
Bible
Plans
Videos