1
Ekklesiastes 2:26
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
God dey give wisdom, knowledge and joy to pipol wey dey do wetin E wont. But if pesin wey dey sin get money and propaty well-well, God go take dem from am kon gi-am to pesin wey dey do wetin E wont. All dis tins dey yuzles too and dem bi like wen pesin dey porshu breeze.
Compare
Explore Ekklesiastes 2:26
2
Ekklesiastes 2:24-25
So I kon sey, nor-tin dey good dan for pesin to chop, drink and enjoy di work wey e dey do, bikos all dis enjoyment kom from God. Bikos nobody go fit chop, drink and enjoy anytin, escept na God gi-am.
Explore Ekklesiastes 2:24-25
3
Ekklesiastes 2:11
But as I sidan dey tink of evritin wey I don do, I si sey all of dem dey yuzles. Dem bi like wen pesin dey porshu breeze! E nor really get anytin wey pesin fit gain for dis world.
Explore Ekklesiastes 2:11
4
Ekklesiastes 2:10
I dey get anytin wey I wont and I nor stop mysef from anytin wey go make mi happy. I dey proud for evritin wey I don work for and na all dis, bi my reward.
Explore Ekklesiastes 2:10
5
Ekklesiastes 2:13
I don si sey, just as lite betta pass darkness, na so too, to know sometin, betta pass foolishness.
Explore Ekklesiastes 2:13
6
Ekklesiastes 2:14
Wise pipol dey si where dem dey go, but foolish pipol dey waka fall for darkness. But I still si sey, both wise and foolish pipol dey sofa di same tins.
Explore Ekklesiastes 2:14
7
Ekklesiastes 2:21
Some pipol work with wisdom; with wetin dem know and with dia skill; but dem go still die leave evritin for anoda pesin wey nor work at-all. Dis tins dey yuzles and nor dey good at-all.
Explore Ekklesiastes 2:21
Home
Bible
Plans
Videos