Even if I won boast, I nor go bi fool, bikos na trut I go still tok, but I nor do am make anybody for tink sey na mi know pass, bikos e si and hear mi dey tok about di betta tins wey I si for vishon. Make I for nor dey karry body up, God put sometin inside mi, wey bi Satan messenja, so dat e go dey trobol mi.