Mark 12:41-42
Mark 12:41-42 PCM
Den, Jesus sidan face di ofrin box, dey look as pipol dey put money inside. Many rish pipol kon dey put plenty money inside. One poor woman wey e husband don die kon kom, put two koins wey nor rish one penny for inside di box.